Police declare Primeboy wanted as investigation into Mohbad death continue

Di Lagos State Police Command don declare Owodunni Ibrahim alias Prime Boy wanted in connection wit di death of Mohbad.

Di police also announce one million naira bounty on im head for anyone wey get useful information wey go lead to im arrest.

Police tok-tok pesin, Benjamin Hundeyin for one statement tok say Primeboy dey wanted sake of im failure to honour police invitation as investigation into di death of Ilerioluwa Aloba dey go on.

“Ibrahim dey approximately 1.64-m tall, male, dark-complexioned, e get tribal marks and e be Yoruba by tribe. His last known address na 3rd Power Oke Eletu, Ikorodu.” Di statement tok.

Even before police declare am wanted, rumour don dey spread say Primeboy get hand for di death of di young star.

Primeboy also bin don address di rumour on im social media page. E clear am say im no get hand for Mohbad death as di singer na im childhood friend.

E also tok about dia last outing togeda wey some pipo allege say get something to do wit im death.

“Nothing happun between me and my friend. Mohbad na my childhood friend, my close friend. I gain a lot from am, e dey give me free access to meet pipo foe di industry, why I go kill my friend my friend.?” E tok for di video e do for im Facebook page.

Primeboy add say on Mohbad last outing dem bin dey togeda.

“I and Mohbad bin dey on stage togeda and e don high well-well, we come down stage and we sit for im car togeda wit im wife, e insist say e wan dey go house as e no dey comfortable again, I tell am say make e relax make I go clear road for am,” E no end di statement finish.

Owodunni Ibrahim also na singer.

Dis development dey come few hours afta Police say Azeez Fashola wey pipo know as Naira Marley dey dia custody.

Di Lagos state police command confam say Naira Marley dey wit dem on Tuesday night.

Tok-tok pesin of di command SP Benjamin Hundeyin for im post on X say “Naira Marley don dey our custody for interrogation and oda investigation activities.”

MohBad die on 12 September at di age 27.

Di death of MohBad na one wey touch many Nigerians and spark a call for justice following reports wey allege say e suffer bullying, harassment and assault as a musician wey bin dey signed under di music label Marlian records.

Tori be say Naira Marley wey be di owner of Marlian records enta Naija to help police for di investigation of Mohbad death.

Di record label owner, wey also be popular musician Naira Marley don deny all accuse say im get hand for Mohbad death.

For one statement wey im release earlier, Naira Marley tok say im also dey traumatised sake of di death of im former signee just like evri oda pesin dey traumatised.

Naira Marley tok say Mohbad bin leave di record label for September 2022 and add say di misunderstanding wey dem get no reach make dem wish di oda pesin death.

“Truly, we get our own share of misunderstanding wen we dey work togeda, but di disagreement no reach wetin wey pipo dey paint. E no reach where we go wish each oda death,” Naira Marley tok for di statement.

On Tuesday, di singer for im post on X say im dey Lagos, South west Nigeria to assist in di ongoing investigation of di death of late Ilerioluwa Aloba alias MohBad.

“I go like to share say I just arrive back in Lagos, Nigeria to assist di authorities wit di ongoing investigation. E dey important for me to do my part for Imole.

“I go meet wit di police wit hopes for di truth to dey uncovered and for justice to prevail.” E tok.

Source