Over 20 traders confam dead for Kebbi boat accident

Search for bodies dey continue afta boat accident for Kebbi state, northwest Nigeria leave plenty pipo dead and many still missing.

According to di Kebbi state goment na 23 pipo dey confirmed dead after di Monday afternoon incident wey just dey come to light.

Di passengers, all traders dey try reach di Yauri weekly market wey dey operate every Monday.

Dis na di third high profile boat accident in recent month after two happun for Niger state leave dozens of pipo dead.

“Di passengers leave Kasabo village dey try reach Yauri town for dia commercial activities na im dis incident occur.” statement from goment tok.

“We no fit question God but we dey condole with di families over dis incident and dey pray for di victims to rest in peace.”

‘One man jump inside water come hold di boat’

Di driver of di boat wey capsize survive di incident.

E narrate wetin happun.

Bala Kasabo tok say bad weather contribute to di disaster wey goment tok say kill 23 pipo.

For video wey dey circulate on social medi, di driver say passengers don board di boat when waves and breeze begin happun inside di water.

“Immediately I notice di waves and breeze I find place park come tell di passengers to go down but some say dem no go comot since dem don pay money.”

“Na im we continue di journey.”

“Wen di wind increase na im one man jump inside water come hold di boat and di boat na small boat how e no go capsize?”

Clearly shaken from wetin happun di driver say di heavy wind na im cause commotion inside di boat as pipo shift to one side and di engine no come fit move di boat.

Surrounded by rescue workers and pipo wey come watch, di driver insist say di pesin wey first jump inside water no suppose hold on to di boat since heavy wind dey blow as na wetin cause di accident.

One eyewitness say di traders leave Kasabo village around 12:00pm on Monday with plan to do commercial activity for Yauri market.

“No be all di passengers come from Kasabo village some na from Kontagora and dia plan na to come Yauri market.”

“All di corpses don comot from di water na only one remain and divers still dey try get dat one.”

“Di seven pipo wey comot from di water alive first visit hospital for checks and I hear some dey dia houses now.” E tok.

Nigeria no be stranger to boat accidents at all.

Overloading na one factor wey don dey identified as a cause of dis boat accidents.

For October 2022, 10 pipo die afta one jetty wey suppose carry 48 pipo but carry 85 instead, for Onitsha, Anambra state get acident.

Di boat accident happun on Friday 7 October.

For May 2021 plenti pipo miss and odas die afta di boat wey dem dey travel wit sink inside river for Kebbi state, north west Nigeria.

Source