Family of gospel singer Aduke Gold tok wetin kill am and wen her burial go happun

Family of gospel singer Aduke Gold don tok say na cervical cancer kill di gospel singer wey die on Monday, 12 August.

Na Esther Igbekele wey also be gospel singer break di news of Aduke death through her Instagram page.

Di elder brother of di late singer, Pastor Ajayi Aderounmu, tell BBC say na cervical cancer kill Aduke.

“Regarding Aduke death, cervical cancer kill am, becos e appear for her death certificate”.

Pastor Aderounmu say Aduke bin dey stay for im place bifor and comot about five years ago.

E say Aduke bin call am three weeks ago and she no sound like pesin wey sick.

Pastor Aderounmu tok say na on Monday wey Aduke die im first hear say she bin dey sick.

Earlier, di University College Hospital (UCH) Ibadan don react to di death of popular gospel singer afta one video bin trend on social media wia one man bin tok say “finally, UCH release Aduke bodi afta several hours of shouting, screaming, dem finally release am”.

Funeral arrangements for Duke Gold

Pastor Ajayi tok say di Ajayi’s family bin meet wit Gospel Musicians’ Association of Nigeria (GOMAN), and dose di mata affect.

E tok say dem go bury Aduke on Friday, 23 August 2024, but add say dem neva pick specific place wia dem go bury am.

Pastor Aderounmu tok say di candlelight procession go first take place on Wednesday, 21 August August.

E say artistes night go take place on Friday, 22 August 2024, and add say di program go start by 6pm to 6am.

Pastor Aderounmu say di two programmes go take place for Karaole Primary School, wey dey for Ifako, College Road, for Lagos State, southwest Nigeria.

Who be Aduke Gold?

Dem born Aduke Ajayi, wey many pipo sabi as Aduke Gold, for 1990 for Ilesha, Osun State.

Aduke Ajayi bin lose both her parents wen she dey four years old.

Wen she first start her music career, pipo bin dey call her Aduke Penkele sake of how slim she dey and look for stage.

Di late Aduke Gold bin get opportunity of free education to go university wen one commissioner for youth affairs and sports for Lagos State at dat time, Opeyemi Bamidele, bin give free education.

And she graduate for Lagos State University wit degree for International Relations.

Late Aduke Gold also study about children, and gbab Diploma award for United Kingdom.

Aduke Gold also learn about pipo wit special needs, di care and breeding of fish, teaching and cake making, apart from di music wey make her popular.

On Monday night, August 12, 2024, Aduke Ajayi bin leave di world.

We dey update dis tori

Source