Kontris begin put in place health measures to control spread of Mpox

Foto of Mpox patient for DCR hospital

Getty Images

Afta World Health Organisation (WHO) declare Mpox wey pipo sabi as Monkey Pox as global health emergency, some kontris don begin put in place measures for dia airports and seaports to ensure say travellers fit travel safely as new variant of Mpox dey spread globally.

On Wednesday, World Health Organization declare Mpox as global health emergency of public concern for di second time in two years, afta di outbreak of di highly infection disease for Democratic Republic of Congo wey don spread to twenty-six kontris across di world.

For May 2022, WHO bin declare Mpox as global health emergency wen di virus spread to more dan seventy kontris and dem confam say e fit spread through sexual contact.

Di new variant wey dem discover as clade 1 b, dey more deadly and easily transmittable dan clade 2b variant wey dem bin discover for 2022.

So far, kontris for Africa na di most infected as dem don confam 2,863 cases and 517 death, while DRC declare16,789 cases, including 511 death – dis na di highest number globally – according to Africa Centres for Disease Control and Prevention (Africa CDC)

Mpox travelling measures across borders

Although, many European kontris neva put in place travel measures for dia citizens, European Centre for Disease Prevention and Control (ECDC) on Friday recommend make dem get vaccinated and advise kontris make dem begin put in measures to control di Mpox C1 variant wey don affect kontris like Democratic Republic of Congo, Burundi, Rwanda, Uganda and Kenya.

Di United States tok say dem go kontinu to work closely wit African goments, Africa CDC and WHO to ensure effective response to di current outbreak of Mpox while dem advise dia citizens make dem get vaccinated even though dem neva report any case for US

Asian kontris like China, Thailand and Malaysia don put in place strict travelling measures for dia kontris wey dey similar to Covid-19 pandemic travelling restrictions.

China don put in place strict border control for pipo wey dey show symptoms, wey don travel to kontris wia Mpox dey prevalent or dey affected by Mpox.

Authorities for China airport go ask surveillance question to put di pesin for isolation so dem go fit arrange test and treatment.

Chinese authorities also don warn dia citizens against travelling to some parts of Congo and di Central African Republic for safety concern unrelated to mpox.

Currently, India and Pakistan no get strict measure but dem tok say dem go begin test travellers for dia airports.

Meanwhile, among African kontris, South Africa tok say dem go begin to dey screen travellers for airport while Kenya tok say dem don begin to dey test travellers and na mild cases dem don get so far.

Nigeria don mandate all travellers wey dey enta di kontri make dem fill declaration form for airport or online if dem travel to some parts of Africa.

Mpox spread for Africa

BBC

Mpox dey treatable?

World Health Organization don tok say cases dey prevalent for East Africa kontris like DR Congo, Burundi, Kenya, Uganda and Rwanda.

Vaccines don dey available, WHO recommend di use of MVA-BN or LC16 or di ACAM2000 vaccines. Mpox vaccines dey provide protection against infection and severe disease. But you go need to take care of yoursef to avoid catching and spreading di virus.

According to di US Centre for Disease Control and Prevention, pipo need to take di two doses of di vaccines, to get di best protection, dem must to take di second dose four weeks afta dem take di first one.

Foto of tins you need sabi about Mpox

BBC

How to protect your bodi from Mpox

Dis recommendations na from US Centers for Disease Control and Prevention, UK National Health Service and WHO wey include:

  • Avoid contact wit pipo wey recently get di virus or those wey fit dey infected. Wear face mask if you dey in close contact wit someone wey get symptoms.
  • Use condom and shine ur eye for symptoms if you recently change your sexual partner. Avoid contact wit animals wey fit carry di virus. Dis include sick or dead animals and particularly those wit history of di infection, like monkey, rodents and prairie dogs.
  • Practice good hand hygiene, especially afta you come in contact wit infected — or suspected infected — animals or humans. For example, wash your hands wit soap and water or use an alcohol-based hand sanitizer.
  • Use personal protective equipment wen you dey care for patients wit confirmed or suspected monkeypox infection.
  • Only eat meat wey dem cook well-well.

Source