Suspected serial killer wey allegedly kill 42 women and im wife run comot from police custody

Kenyan suspect Collins Jumaisi Khalusha stands against a yellow wall in court

AFP
Mr Khalusha still dey police custody while dem still dey investigate di multiple killings

One suspected serial killer for Kenya don escape from custody, and dem don begin dey find am, police tok.

For July, police tok say Collins Jumaisi Khalusha confess to di murders of 42 women, including im wife, since 2022.

Mr Khalusha lawyer deny di claim, and tok say dem torture im client to confess.

E don dey police station since dem arrest am for July, but on Tuesday authorities tok say Mr Khalusha and 12 odas escape by cutting through wire mesh roof and scaling perimeter wall.

Incident report from di station say police discova say di detainees dey miss at 05:00 local time (03:00 GMT) wen officers dey serve breakfast.

Di 12 individuals wey run alongside, Mr Khalusha na Eritrean nationals wey dem detain for entering di kontri illegally, di police tok.

Dem detain 33-year-old Mr Khalusha afta di discovery of nine mutilated bodies for one abandoned quarry for di capital, Nairobi.

Di victims dey between di age of18 and 30 and im allegedly kill dem all in di same way, according to di police.

Di death of im victims spark shock and outrage. Many question how 42 pipo fit die in di space of two years witout police noticing and also how officers fail to detect say dem leave di bodies inside quarry around 100m (109 yards) from police station.

Kenya police watchdog launch investigation to establish weda di police dey linked to di killings, following “widespread allegations of police involvement in unlawful arrests [and] abductions”.

Dem neva release dia findings.

Police for Kenya don dey accused of scores of human rights abuses in di past – and di force dey currently under investigation ova deaths and abductions following recent anti-goment protests.

At di time of Mr Khalusha arrest, Directorate of Criminal Investigations (DCI) chief Mohamed Amin tok say: “E dey clear say we dey deal wit serial killer, psychopathic serial killer wey no get respect for human life, wey no get respect and dignity.”

Mr Khalusha lawyer, John Maina Ndegwa, tell di BBC for July: “E tok say dem strangle am to confess. You fit tell say e dey in distress, terrified and in anguish.”

Di suspect appear for one court for Nairobi on Friday, wen di magistrate order say make dem hold am for anoda 30 days so police go fit complete dia investigations, news agency AFP report.

Di discovery of di dismembered bodies come as di kontri still dey shake from di so-called Shakahola forest massacre, wia dem find more dan 400 bodies for mass graves near di Indian Ocean coast.

Cult leader Paul Mackenzie bin allegedly encourage im followers to starve demsefs in order to “go see Jesus”.

E don plead not guilty to manslaughter.

Source