Wetin we know about di 20-year-old FBI say carry out assassination attempt on Trump

Trump raise im hand as agents try to carry am off stage afta di assassination attempt

Reuters

Di man wey attempt to kill Donald Trump na one 20-year-old Thomas Matthew Crooks, according to one FBI statement dem release a short while ago.

Dem say dem don “tentatively identify” di man but say DNA and biometrics tests go need to dey done to conclusively confirm im identity.

Di statement say Crooks na from Bethel Park of Pennsylvania.

Dis na a town about 70km (43 miles) or one hour drive from Butler, di site of di attempted assassination.

“Dis place remain an active and ongoing investigation, and anyone with information wey fit assist with di investigation dey encouraged to submit photos or videos online,” di statement add.

“Na matter of doing biometric confirmations. No identification bin dey on di individual. We dey look pictures right now. We dey try to run im DNA and get biometric confirmation.” FBI special agent Kevin Rojek bin tok.

What we know about di shooter in bullet points

Wetin we know about di alleged shooter so far? Dis na wetin we sabi:

  • FBI don identify am as Thomas Matthew Crooks.
  • Thomas Matthew Crooks be 20 years old
  • E bin come from Bethel Park for Pennsylvania (70km/43 miles) from Butler, di site of di attempted assassination
  • Secret Service agents shoot di gunman dead – di FBI bin no name am immediately while dem dey wait for DNA result
  • E be registered Republican, according to state voter records
  • But according to Reuters, wen e be 17, e make $15 donation to ActBlue, one political action committee wey dey raise money for left-leaning and Democratic politicians
  • E graduate for 2022 from Bethel Park High School, according to di Pittsburgh Tribune-Review. E receive one $500 “star award” from di National Math and Science Initiative, di paper add
  • Im father, Matthew Crooks wey be 53-year-old, tell CNN say im still dey try figure out wetin happun and go wait until im follow law enforcement tok before e say anytin
  • Law enforcement officials bin tok on Saturday say Crooks no carry any form of identification go di site of di shooting and dem gatz identify am wit oda methods
  • Dem neva identify any motive, but authorities dey treat di shooting as “assassination attempt”

Di FBI statement add say di mata remain an “active and ongoing investigation”.

Witness tell BBC say e see gunman ontop roof

Eyewitness tell BBC say im see one man with rifle on a rooftop minutes before shots bin dey were fired against Donald Trump for im rally for Pennsylvania.

Greg Smith say di man bin crawl on top of a building just outside di event for Butler County on Friday evening.

E say e point di gunman out to police.

“I dey think to myself ‘Why Trump still dey speak, why dem never pull am off di stage’… di next thing you know, five shots ring out.”

Secret Service agents immediately cover di former president and escort am comot. Blood bin dey im face and e later say one bullet pierce im ear.

Officials later confirm say dem shoot di gunman dead. Mr Smith tell BBC say e bin see Secret Service agents shoot di man.

Mr Smith bin dey listen from outside di rally and e say e see di gunman around five minutes into Trump speech.

“We notice as di guy dey crawl go up di roof of di building beside us, 50ft away,” e tok. “E hold rifle, we see clearly say na rifle.

“We dey point am, di police bin dey down dia dey run around on di ground, we be like ‘Hey man, one guy dey di roof with rifle’… and di police bin no know wetin dey go on.”

Mr Smith say e bin try to alert di authorities for three to four minutes, but reason say maybe dem no fit see di gunman because of di slope of di roof.

“Why Secret Service no dey all of these roofs here?” e ask. “Dis no be big place. “[na] security failure, 100% security failure.”

E say e later see di agents shoot di gunman: “Dem crawl up go di roof, dem point dia guns at am, make sure say e don die. E don die, and na so – e don over.”

Anthony Guglielmi, one Secret Service spokesman, say agents bin “neutralise di shooter” and “quickly respond with protective measures”.

Dem dey investigate di incident as an attempted assassination.

One crowd member die and two others dey critically injured, di service add.

Mr Smith later tell BBC say im pikn bin dey “cry and beg make dem carry am go house” after di shooting.

“Plenti kids bin dey up dia with us wey bin dey fear, dem still dey fear,” e tok.

Another witness wey bin dey inside di event describe how e take cover after hearing five gunshots wey ring out sharp sharp.

Jason, wey no give im surname, tell BBC say: “We see di Secret Service jump on Trump to protect am; everyone on di ground drop down very quickly.

Den e stand come “put im fist up in di air”.

“E bin dey a little bloody, im ear bin dey bleed. E stand up and e dey alive and breathing.”

One emergency department doctor for di rally tell CBS News, BBC US partner, say e treat one crowd member for gunshot wound to di head.

“I hear di shots, I think say na firecrackers initially,” e tok.

“Someone over dia come dey scream ‘dem don shoot am, dem don shoot am’.

“Blood bin plenty.”

How close di suspected gunman bin dey to Donald Trump?

BBC Verify graph show how close di suspect bin dey to Donald Trump

BBC
BBC Verify graph show how close di suspect bin dey to Donald Trump

According to eyewitness accounts, di man wey carry out attempted assassination on Donald Trump bin carry gun and e bin dey on top one roof wey dey less dan 200 metres from di former president.

Di plenty videos wey don comot since di shooting, clearly show wia di man dey.

One key part of di video, wey dem take from di south of one flat warehouse wit beige walls, show wetin be like di lifeless body of di shooter.

As BBC Verify compare dis images from Google Maps, plus di location of trees and eyewitness accounts, dem confam say na im dey on top of dis building.

Authorities too don confam am. Na short distance dey from di di stage wia di rally bin dey hold to wia di suspect take position, and dis don lead to difficult questions for di security services.

Source