How Arsenal blow two goal lead to draw for West Ham

Bukayo Saka miss penalty

Reuters

Arsenal troway dia two goals lead to draw 2-2 for dia Premier League match against West Ham for London stadium.

Gabriel Jesus and Odegaard score for di 7th and 10th minute but West Ham take over di second half as Benrahma and Bowen score two goals to make mata worse for Arsenal.

Di Gunners wey dey try to win di league title dis season still drop points for dia second game back to back.

Arsenal still get four point lead over Manchester City wey dey second for di table wit 70 points but Manchester city still get one match wey dem neva play.

Di two title contenders go kwanta for di Etihad on 26 April.

How di match bin happun live

Arsenal and West ham players struggle for ball

Getty Images

Second Half

Full Time West Ham 2-2 Arsenal

90+5 Referee blow final whistle, match don end.

90+4 Ben White of Arsenal send cross into di box but West Ham defence clear di ball.

90+2 Jarrod Bowen take corner kick but one of di defenders block am wit im head as im jump head di ball comot.

90+1 Substitution for West Ham, Pablo Fornals don enta for Mohamed Said.

90 +1 Martin Odegaard of Arsenal don play finish, Eddie Nketiah don come in for am.

90′ Five minutes added time.

88′ Substitution

Lucas Paqueta don comot, Flynn Downes don come in.

87′ Substitution for West Ham

Michali Antonio don comot. Maxwell Cornet don enta.

85′ Substitution

Fabio Vieira don enta for Kieran Tierney.

85′ Substitution for Arsenal.

Gabriel Martinelli don comot. Reis Nelson don replace am.

83′ Aaron Cresswell of West Ham don collect Yellow card sake of foul.

81′ Jorginho of Arsenal pass beat ball to Leandro Trossard but notin come out from di pass.

79′ Mohamed Said Benrahma of West Ham play one beat cross but Aaron Ramsdale punch di ball comot.

78′ Aaron Cresswell play di ball into di penalty area for di corner kick.

78′ Jarrod Bowen find way enta di box wit one hot shot. But im no fit beat di goalkeeper. But dem get corner kick.

76′ Arsenal players dey exchange fine passes, dem dey wait for chance to attack but dem don lose possession.

75′ Kurt Zouma try to find Michali Antonio but im put too much power for di thru ball. Di ball go out of play and Arsenal get goal kick.

70’ Beta effort by Bukayo Saka of Arsenal, im find im way go meet di goalkeeper con pass a low ball to di middle of di net but Lukasz Fabianski clear di ball.

69’ West Ham dey play beta team football, dem dey do short short passes as dem dey wait to open Arsenal defence.

67’ Anoda substitution for Arsenal as Leandro Trossard don enta for Thomas Partey.

67’ Substitution for Arsenal, Mikel Arteta don remove Gabriel Jesus, na Jorginho dey replace am.

66’ Gabriel Martinelli play corner kick , im play di ball go di penalty area but West Ham defence clear di ball.

64’ Kurt Zouma of West Ham jump high to connect wit one cross wey dey go near di net.

60′ Lucas Paqueta of West Ham bin wan release Michali Antonio wit thru ball but defenders cut short im effort.

55′ West Ham 2-2 Arsenal.

55′ Jarrod Bowen of West Ham get one beta cross inside di box, im shoot am pass di helpless goalkeeper, di ball jump enta di right post of di net.

55‘ Goal!

52′ Bukayo Saka miss di penalty, im no fit convert am. Im shot go wide of di left post. Di ball go out of play and West Ham get goal kick.

52′ Miss!

52′ Bukayo Saka wan play penalty for Arsenal.

46′ Referee blow whistle to begin second half.

First Half

West Ham vs Arsenal Live updates

Getty Images

West Ham 1-2 Arsenal

First Half don end

45+5′ Referee blow whistle.

45+4′ Gabriel Jesus collect yellow card sake of foul.

45′ Linesman show 3 minutes added time

45′ Aaron Cresswell of West Ham dey for clear offside position.

43′ Kierian Tierney of Arsenal no fit find any of im teammates inside di box as West Ham block im pass.

41′ Bukayo Saka play di ball to Gabriel Martinelli, dem continue dia attacking move.

37′ Thomas Soucek of West Ham get imsef onto di end of di corner but dem block im header. West Ham don get corner kick.

32′ West Ham 1-2 Arsenal

32′ Behrahma score penalty for West Ham

32′ Goal!

31’Bukayo Saka of Arsenal pass one cross inside di box, im try to find im teammates but di West Ham defence clear di ball.

31′ Arsenal take di freekick wit short pass.

30′ Thilo Kehrer of West Ham make one rough challenge and David Coote blow im whistle for foul. Arsenal get freekick.

29′ Referee stop play as Linesman raise offside flag for Vladimir Coufal of West Ham.

27′ Gabriel Jesus clip one neat ball into di box direction wia Ben White dey, but im no fit reach di end of di pass. Di ball go out of play and West Ham get goal kick.

26′ Arsenal players dey exchange short passes.

21′ Ben White of Arsenal send one long ball go front to Gabriel Martinelli but im put too much power con waste di chance.

19′ Beta defence!

Kieran Tierney of Arsenal try to find Martin Odegaard inside di box but dem cut short di pass.

17′ Mohammed Said Benrahma of West Ham commit one yeye tackle on im opponent, referee say make dem play on!

12′ Martin Odegaard of Arsenal give pass to Gabriel Jesus but im no fit get di ball.

12′ Arsenal dey play possession football and dem dey control di game now. Dem dey pass di ball from player to player and e dey make am hard for West Ham to collect ball from di leg.

10′ West Ham 0-2 Arsenal

10′ Gabriel Martinelli pass one soft cross inside di box. Martin Odegaard of Arsenal cari di ball. Im finish wit a quick low shot inside di middle of di net.

10′ Goal!

7′ West Ham 0-1 Arsenal

7′ Ben White pass di ball to Gabriel Jesus of Arsenal, im just put di ball inside empty net.

7′ Goal!

4′ Handball by one of Arsenal players for di box but di referee wave say make dem play on!

3′ Granit Xhaka of Arsenal play free kick wit short pass.

1′ Match don start!

West Ham Line up: Fabianski, Coufal, Zouma, Kehrer, Cresswell, Soucek, Rice, Bowen, Lucas Paquetá, Benrahma, Antonio

Arsenal Line up: Ramsdale,White, Holding, Gabriel,Tierney, Ødegaard, Partey, Xhaka, Saka, Gabriel Jesus, Martinelli