Samuel Eto’o: Cameroon elect former football star president of di kontri football federation

Samuel Eto'o

Getty Images

Cameroon don elect former football star Samuel Eto’o as di president of di kontri Football Federation (Fecafoot).

Dem elect am on Saturday, 11, December, 2021, just about one month before di kontri go host di African Cup of Nations.

Eto’o dey replace Mbombo Njoya as di new Fecafoot boss.

Di four-time African Footballer of di Year defeat im rival Seidou Mbombo Njoya, wey be di fourth vice-president for di Confederation of African Football.

Eto’o, wey be 40 years don promise ogbonge changes to wake up di sport.

Getty Images
Gilbert Schlick, di president of di electoral commission, and Samuel Eto’o Fils during di election

“We get to bring footballers to di centre of our policies,” e tok afta di election. “Na our role to ensure say those wey dey play dis game dey make a decent living out of am.” E tok.

Di former Barcelona, Inter Milan and Chelsea star don also promise to build at least 10 stadiums during im mandate.

“I don speak to di business community and we dey certain say we go get di right investors wey go help us to achieve our goals,” Eto’o bin tok before di polls.

Eto’o decision to contest draw attention, dem broadcast di election live on national Cameroon television.

Before di election, some football greats bin don wish am well for im journey.

Cameroon legend Roger Milla and Bafana Bafana legend Aaron Mokoena bin issue support to Samuel Eto’o.

Bafana most capped player, Mokoena bin feel say retired players get wetin e take to lead di Football Associations.

“Dis na Aaron Mokoena, di former Bafana Bafana captain, I just wan wish you all di best for your elections tomorrow,

E don reach time for us to show say we fit take our football to anoda level. For me personally, di fact say you don play di game for di highest level I think say you deserve to be di president of Cameroonian FA.” Mokoena tok inside one video clip.

Eto’o, wey pipo believe to be one of di greatest African footballers of all time, bin dey up against five fellow candidates Jules Denis Onana, Nyamsi Jean Crepin, Seidou Mbombo Njoya (incumbent), Tagouh Justin and Wandja Zacharie.

Eto’o go run football mata for Cameroon for di next four years.

Samuel Eto'o is a four-time African Footballer of the Year

BBC

Who be Samuel Eto’o?

Some go say e be one Africa best footballers of recent times, Eto’o – Cameroon all-time top scorer – join Spanish giants Real Madrid for 1996 at di age of 16 before e go on loan for Leganes, Espanyol and Mallorca.

E sign permanent deal with Mallorca for 2000, e score 54 goals inside 133 outings to establish imself as di team all-time leading scorer.

E move to Barcelona for 2004 wia e win three La Liga titles, to epp di Catalans to two European Champions League wins for 2006 and 2009, wia e score for both finals.

For 2006, Eto’o become di first and only African to win di Spanish Golden Boot afta e net 26 times in 34 matches.

Di forward score 108 goals in 144 games for di Nou Camp side before e join Inter Milan for 2009, wia e win im third Champions League crown as well as Serie A title and di Fifa Club World Cup for 2010.

Internationally, Eto’o epp di Indomitable Lions to win two successive Africa Cup of Nations for 2000 and 2002 and go on to become di tournament record scorer with 18 goals.

For 2000, e guide Cameroon to Olympic gold medal, wia e score for di final.