Nigeria vs Benin Afcon qualifiers team news & kick-off time

Nigeria dey group D for Afcon qualifiers

Getty Images
For di last Afcon, Nigeria bin reach final but lose 2-1 to Ivory Coast

Nigeria go face Benin for dia first Afcon 2025 qualifying match on Saturday evening.

Dis game dey come barely two months ago wey di Super Eagles bin lose 2-1 to Cheetahs for dia world cup qualifying match.

48 national teams across di continent dey take part for dis campaign.

Di Confederation of Africa (Caf) divide di teams into 12 groups, dem go den battle am out in a series of matches.

Na di top two finishers for di 11 groups wey no involve tournament hosts Morocco, go qualify for di competition.

Nigeria dey group D for di qualifiers, di group also get Benin, Rwanda and Libya inside.

24 teams go compete di 35th edition of di ogbonge football competition wey go hold between 21 December and 18 January for Morocco.

Date, kick-off time and venue

Di match go take place for di Godswill Akpabio stadium for Uyo, Akwa Ibom state on Saturday 7 September.

Kick-off time na 5pm West African time.

Nigeria Football Federation begin sell ticket for di ogbonge match on Friday.

Where to watch Nigeria vs Benin

You fit live stream di match for Afrosport TV , Afrosport TV

Follow all di action live for BBC Pidgin website, we go bring you all di live-text commentary as e dey happun.

Nigeria vs Benin team news

Ademola Lookman dey expected to start for Nigeria and Captain William Ekong, wing-back Olaoluwa Aina all dey fit to start dis game.

Goalkeepers: Stanley Nwabali, Maduka Okoye, Amas Obasogie

Defenders: William Ekong, Bright Osayi-Samuel, Olisa Ndah, Bruno Onyemaechi, Oluwasemilogo Ajayi, Calvin Bassey, Olaoluwa Aina

Midfielders: Wilfred Ndidi, Raphael Onyedika, Alhassan Yusuf Abdullahi, Fisayo Dele-Bashiru ,Frank Onyeka, Alex Iwobi

Forwards: Samuel Chukwueze, Victor Osimhen, Kelechi Iheanacho, Victor Boniface, Moses Simon, Ademola Lookman , Taiwo Awoniyi

Nigeria vs Benin head to head record

Whenever Nigeria and Benin jam for match, e dey tough and e dey unpredictable. Di rivalry between dis two West African neighbours deep, and dis qualifiers no go dey different.

Di Super Eagles wey bin reach di final of di last Afcon bin lose to Benin for June dis year wit goals from Jodel Dossou and Steve Mounié.

For dis game di Cheetahs go dey hope say dem fit repeat am again.

Nigeria record against Benin good but di last meeting between di two sides na di visitors collect all three points

Caf World Cup qualifiers 10 June 2024: Benin 2-1 Nigeria

Caf Africa Cup of Nations qualifiers 27 March 2021: Benin 0-1 Nigeria

Caf Africa Cup of Nations qualifiers 13 November 2019 : Nigeria 2-1 Benin

Caf Africa Cup of Nations 16 January 2010 : Nigeria 1 – 0 Benin

Caf Africa Cup of Nations 29 January 2008 : Nigeria 2- 0 Benin

Source