Argentina beat Australia 2-1 to move on to di Quarter Finals

Messi in action

Getty Images

Lionel Messi produce a moment of magic on im 1,000th career game as two-time champions Argentina beat Australia to reach di World Cup quarter-finals.

Messi, 35, bin dey make im 119th appearance for im kontri and dem bin need di help of im brilliance to take dem through to di next round and a tie against di Netherlands on Friday.

Though Argentina no too threaten in di first half, Paris St-Germain Messi score to spark wild celebrations from dia fans.

Body sweet dem more wen Julian Alvarez punish Mat Ryan mistake to double dia advantage.

Australia manage pull one back in with 13 minutes remaining wen substitute Craig Goodwin strike deflect from Enzo Fernandez.

Dem for level small time afta through Aziz Behich ogbonge solo run, but im shot bin dey blocked by Lisandro Martinez sliding challenge as Argentina edge through.

Di match as e happun

SECOND HALF

FULL-TIME

Argentina 2-1 Australia

All over. Argentina go play Netherlands on Friday for a place in di World Cup semi-finals.

90+7 mins: Australia Garang Kuol almost send di game to extra time. Im shots from 10 yards out dey saved by Emiliano Martinez.

90+5 mins: Argentina get about four chances. Two shots dey blocked, den Lautaro Martinez shot dey saved by Mat Ryan feet and di rebound hit Lionel Messi and go wide.

90 + 4 mins: Lionel Messi almost score from di corner of di area but e shoot just over.

90 + 2 mins: Lionel Messi beat one man and win throw-in.

INJURY TIME

Argentina 2-1 Australia

Dem add seven minutes more.

90 mins: Argentina keeper Emiliano Martinez catch one looping ball and go down as if e bin injure.

87 mins: Di ball drop to Argentina striker Lautaro Martinez for di box at di end of a long passing move but e snatch am and e roll wide.

85 mins: Lionel Messi run to catch one long ball forward but e no fit beat di defender. E bin dey offside too.

82 mins: Dundee United Aziz Behich almost score for Australia.

E take on several players as e run wit di ball. E cut inside Nicolas Otamendi and but just as e bin wan fire shot, to make am 2-2, Lisandro Martinez block im shot and save Argentina.

80 mins: Argentina do a double change.

Exequiel Palacios and Gonzalo Montiel replace Alexis Mac Allister and Nahuel Molina.

76 mins: GOAL!

Australia don score. But na own goal.

75 mins: Lautaro Martínez pass di ball to Nicolas Tagliafico, e fire shot wide of the far post.

72 mins: Australia sub too. Newcastle new signing Garang Kuol na one of those wey come on.

71 mins: SUBSTITUTION

Argentina goalscorer Julian Alvarez dey replaced by Lautaro Martinez.

Nicolas Tagliafico replace Marcos Acuna too.

70 mins: Marcos Acuna put im head for im hands. E beat Milos Degenek and for get chance to score but di officials rule say e foul Degenek to reach dia.

66 mins: Lionel Messi of run from midfield, e beat several players, before e go around di box and beat some more players. Dem tackle am before e fit shoot.

63 mins: One Australia set-piece no do anytin.

SUBSTITUTION

Just afta di goal Australia bring on Craig Goodwin and Ajdin Hrustic for Riley McGree and Keanu Baccus.

57 mins: GOAL!

Di Australia goalkeeper take one heavy first touch from a backpass and step past Rodrigo de Paul before e run enta Julian Alvarez.

Alvarez take di ball from di goalkeeper and place am for di bottom corner of di empty net.

55 mins: Mat Ryan run out of im box to head ball out of play from Argentina.

46 mins: KICK-OFF

Argentina 1-0 Australia

Argentina second goal

Getty Images

FIRST HALF

45+2 mins: Half-time whistle go off and na Argentina 1-0 Australia.

45 mins: INJURY TIME

Two minutes dey added on.

39 mins: YELLOW CARD

Australia Milos Degenek collect card afta e catch Marcos Acuna for air. E be di second Australian who go dey suspended for di quarter-final.

34 mins: GOAL!

Argentina 1-0 Australia

Messi score.

Di ball land near am near for di edge of di box from Nicolas Otamendi touch and Messi put di ball past Mat Ryan. .

33 mins: Behich foul Gomez and dem give dem free kick for a good place. Messi take am but e dey headed away by Harry Souttar.

28 mins: Corner for Australia. Riley McGree take am and e find Harry Souttar. Di defender jump over Nicolas Otamendi and head di ball into di ground and Argentina clear am.

27 mins: Corner kick for Argentina, Molina play am.

25 mins: Aaron Mooy corner dey headed away by Nicolas Otamendi. oice at the back.

20 mins: 20 minutes into di game and no too much action.

18 mins: Australia Aziz Behich enta di box, for di byeline, and Rodrigo de Paul stop am.

14 mins: YELLOW CARD

Australia Jackson Irvine foul Marcus Acuna and e collect Yellow.

11 mins: Julian Alvarez dey offside as e run for one ball but Harry Souttar defend am well.

10 mins: Harry Souttar play one nice diagonal ball to Mathew Leckie but e no fit control am.

9 mins: Alexis Mac Allister dey fouled and Argentina get a free-kick 40 yards out. Lionel Messi touch give am to Australia. Argentina get di ball back and Julian Alvarez no fit control Nicolas Otamendi pass.

8 mins: Matt Ryan goal-kick enta Argentina hand.

5 mins: One cross hit Keanu Baccus for hand but di referee no give am. VAR too no give am.

4 mins: Argentina call for handball. VAR go check am.

3 mins: Argentina just dey knock di ball around for di back, dem dey try to feel dia way into di game.

I min: Kick off!

Argentina 0-0 Australia

Match stats

Lionel Messi

Getty Images

Australia only win in seven games against Argentina na for dia first meeting for 1988. Current Socceroos boss Arnold play for dat match.

  • Argentina don reach di World Cup knockout stage for di ninth time out of di last 10 World Cups.
  • Messi bin don get 23 efforts without scoring for di World Cup knockout stages for Argentina. But dat one change wit dis match as e score.
  • Australia bin don win consecutive matches and keep consecutive clean sheets for di first time for World Cup. Dia previous clean sheet before di two for dis tournament happun for 1974.

  Head to Head

Argentina and Australia don meet eight times now, Australia win only one match out of di eight for dia first encounter for 1988.

Charlie Yankos score two goals wey help Australia win 4-1 for Sydney.

Since dat time, Argentina don win six of dia last seven games wit one draw.

Na total of 20 goals dem score but Argentina get 13 while Australia get 7

Dis matches na Fifa World Cup qualifiers, International Friendly, Fifa Confederation Cup, International friendly and Bicentennial Gold Cup.

Argentina win: 6

Australia win: 1

Draw: 1

Line up

Argentina

Martínez, Molina, Romero, Otamendi, Acuña, De Paul, Fernández, Mac Allister, Gómez Villaverde, Messi, Álvarez

Australia

Ryan, Degenek, Souttar, Rowles, Behich, Leckie, Mooy, Irvine, Baccus, McGree, Duke