Minister quit afta tori leak say e appoint im former lover as adviser for major events

Italian Minister of Culture don resign afta kasala burst afta di appointment of im former mistress as top adviser bin cause gbas-gbos for di kontri right-wing goment.

62-year-old Gennaro Sangiuliano bin find imsef for di centre of one media kasala wen Maria Rosaria Boccia – im ex-lover – post on LinkedIn say im don appoint am as im adviser for “major events”.

E initially deny di claim, but inside one tearful interview wit state TV on Wednesday, Oga Sangiuliano confam im affair wit Ms Boccia and say im hire her as unpaid consultant.

On Friday, e finally hand ova im resignation to Prime Minister Georgia Meloni, but deny say im no break any ministerial rules.

Oga Sangiuliano also apologise to im wife during di Wednesday interview and claim say e don break im affair wit Ms Boccia during di summer.

E tok say e first met Ms Boccia for Naples for May, bifor dia friendship turn into wetin e refer to as “sentimental relationship”.

Throughout di affair, Ms Boccia dey record her affair wit Oga Sangiuliano wit her phone and one pair of RayBan Stories – one sunglasses wey get camera and microphone wey Meta design.

Many of di fotos dey ontop Instagram, as Ms Boccia insist say “nothing dey illegal” about her secret recordings.

For di fotos ontop her account, Ms Boccia bin document plenty trips wey she go wit oga Sangiuliano on im official visit, wey make pipo ask question as to weda na state money dem dey spend on her travel and her accommodation.

Oga Sangiuliano post fotos on social media showing imself and Ms Boccia

Gennaro Sangiuliano

Di minister don deny any suggestion wey claim say na public funds im dey spend on Ms Boccia, as e tell di state TV on Wednesday say im “no spend single euro” on her travels. E produce documents e claim say back up im claim say im no pay for her expenses.

Critics don also raise concern say Ms Boccia get access to classified information, afta fotos show as she dey follow di minister go Pompeii – di site of next month meeting of G7 culture ministers. Oda fotos show say she get access to di ministry offices and documents.

Since di couple part ways, di 41-year-old don raise plenti accusations against Oga Sangiuliano, wey make her get di nickname “di machine gunner” for di Italian press.

Ms Meloni thank di outgoing culture minister for im “extraordinary work” She write on X say im efforts don “allow di Italian goment to achieve important result for di relaunch and enhancement of Italy great cultural heritage, even beyond im national borders”.

But dis na di latest embarrassment to hit Ms Meloni goment, under di far-right Brothers of Italy party.

Dem don investigate some senior ministers for different kind of scandals, wey include Daniela Santanchè, di tourism minister, wey dey face accusations of false accounting and fraud.

And Vittorio Sgarbi – junior minister – wey dem force to resign afta e face allegations of illegally acquiring valuable Renaissance painting.

Ms Meloni bin vex for her cabinet on Wednesday, as she tell her ministers to employ more caution for dia public activities.

“We dey make history, and we all need to dey aware of am,” di prime minister tok during one meeting. “dis no allow for breaks and pauses, and much less for errors and false steps.”

Despite di scandal, her goment remain relatively popular for opinion polls, as Italy opposition dey fractured among multiple parties.

Source