Erica and Kidd video: BBNaija 2020 housemates ‘entanglement’ for di season five lockdown house

Fans of BigBrother Naija reality show dey drag Erica and Kiddwaya for social media afta video show two of dem dey ‘play love’ under dia bedsheet for di house on Sunday.

Di incident hapun afta di live eviction show for di reality television show.

Although dia actions no too shock fans, onto say, dem tell dia fellow housemates say dem like each oda and on different occasion Erica and Kidd don kiss.

Fans don even give di couple name ‘kiddricca’.

Oda housemates wey don entangle for di show

Praise and Katrina

Praise and Katrina entanglement video shock fans sake of say di two of dem no show any sign of relationship between dem.

Dat na why di video of two of dem for di same bed for night dey play with each oda under dia bedsheet shock fans well-well.