Grenfell path to disaster: How chain of failures and dishonesty lead to 72 deaths

Di Grenfell Tower fire wey kill 72 pipo for 2017 na di result of failures by goment, “dishonest” companies and lack of strategy by di fire service, di final report of di six-year public inquiry don conclude.

Di report set out a “path to disaster” for Grenfell wey stretch back to di early 1990s ova how fire safety for buildings wey high dey managed and regulated.

Di coalition and conservative goment bin “ignore, delay or disregard” concerns about di safety of industry practices, according to wetin di inquiry tok.

One manufacturer wey dey do products wey dem dey use cover surface “deliberately conceal” (hide) di fire risks wey dem fit cause, di report add.

Among di recommendations wey dey laid out for di 1,700-page report na di introduction of one single construction regulator, one College of Fire and Rescue wey go improve di training of firefighters and change di way wey materials dey tested for fire safety.

Di report publication dey come more dan seven years afta di fire take hold and spread through di layer wey dey di west London tower block.

Di fire bin start for one fridge on di fourth floor and spread to di layer through a window bifor e rise go up di sides of di building.

Many residents dey trapped on higher floors as e spread.

Di layer dey made of highly flammable polyethylene wey dey added to di sides of Grenfell Tower in a disastrous renovation for 2016.

Di inquiry find fault and incompetence among almost evri company wey dey involved for di renovation.

We dey update di tori

Source