Modi lose majority – wetin e mean for India?

Narendra Modi look thoughtful as e sddon for table wey dey covered wit flowers

Getty Images

Narendra Modi don ready to make history as e become di prime minister of India for third term back to back.

Some tin wey only Jawaharlal Nehru don achieve – e bin lead di kontri for 16 years afta dem gain independence from colonial rule for 1947.

But Oga Modi victory don dey bittersweet. Im Bhartiya Janta Party (BJP) bin lost majority for Lok Sabha, India lower house of parliament, meaning say dem bin depend on allies to form goment. For im long political career, Oga Modi neva get to lead one coalition goment.

Di BJP bin win 240 seats, down from 303 for 2019. Opposition parties, wey di Congress Party lead, bin fight di election togeda as group dem name INDIA (di Indian National Developmental Inclusive Alliance). Dey beta pass as dem expect, win 232 seats.

Di BJP reduced numbers fit make am trickier to maintain stability for goment, and di party go face much stronger opposition.

Narendra Modi

Reuters
One poster of Mr Modi for di BJP state headquarters for Gandhinagar

Rahul Gandhi, di leader of Congress, bin call di election result moral defeat for di prime minister, e add: “Di kontri don tell PM Modi say we no want you”.

Just like for 2014 and 2019, di BJP bin fight di 2024 elections for Oga Modi name.

E bin dey billboards everywia, dey above all im party colleagues.

For rally afta rally, e bin ask for votes for di name of “Modi guarantee” or im promise to deliver on pledges including to maintain di welfare schemes wey im goment don roll out for di last decade.

So dem see di results dey as one big disappointment to im political reputation.

Why di BJP lose seats?

“Oga Modi cult no doubt don get dent,” Seema Chishti, editor of independent news site The Wire tok.

Di BJP most recent term dey affected by protests against citizenship laws wey many pipo see to be anti-Muslim, and against agricultural laws wey di goment las-las dey forced to roll back.

Oga Modi goment also chop accuse say e dey tackle di media up and use federal investigative agencies to target opposition.

For im first press conference afta di election results, opposition leader Oga Gandhi bin hold one copy of India constitution and declare say di poorest and most marginalised don fight back to save am as dem vote for im party.

Political analyst Yogendra Yadav bin call Oga Modi loss of im majority “di victory of pipo over goment machinery”.

But Oga Modi still get one hero welcome wen e bin waka into di BJP headquarters to thank im party workers afta im win.

Dem give am flower petals as many pipo clap for am and chants of “jai Shri Ram” or “hail Lord Ram” – one nod to di ogbonge role wey religion play for di leader popularity.

Indian Prime Minister Narendra Modi gesture as e land for di Bharatiya Janata Party (BJP) headquarters for New Delhi, India

Reuters
Oga Modi bin greet im followers for di BJP headquarters for New Delhi

If Oga Modi dey worry about wetin dey come next, e no show am.

E go turn 75 next year, age e bin don declare for past say dey right for retirement for im party.

While e don go back since on dat and even claim divine status for imself for im campaign speeches, di possibility of calls for am to step down next year no fit dey ruled out.

But di prime minister bin call im win di biggest victory for di world and tok say e don “inspire am to work even harder”.

And dat fit dey necessary as e step into di unknown territory to lead one coalition.

Senior journalist Poornima Joshi, political editor for national newspaper Hindu Business Line, tok say di prime minister bin first use im “brute” majority to take decisions alone including di sack of key senior leaders.

Di BJP “dey forced to march for military columns behind im general”, she tok, and add say: “Now dat kain discipline go disappear.”

Di party bin lost one of im oldest allies for di run-up to dis elections and engineer one breakup wit anoda, wey suggest misplaced over-confidence to get majority on im own – and willingness to think less of smaller parties.

“Oga Modi don lost major political capital and e no fit now dictate terms and mould policy for di way e bin don dey do for di last two terms,” Ms Joshi tok.

She add say dis fit include to alter some aspect wey define di last decade of di BJP rule – di liberal use of anti-Muslim hate speech.

Wetin di result mean for India Muslims?

Di high-decibel campaign for di 2024 elections bin see Modi seriously dey target India 200 million Muslims – and even dey refer to dem as infiltrators.

For one speech, e bin ask pipo to choose between “vote jihad” and di “rule of Lord Ram”.

One Muslim woman bin tell di BBC: “Nothing dey hidden anymore, e dey all out for di open.”

Election results, especially for Hindu temple towns wit increased polarisation between Hindus and Muslims, suggest say BJP divisive campaign fit don support one opposition wey endorse di secular, inclusive tenets of India constitution.

“Di BJP bin fight di 2014 election on di promise of development, 2019 on di back of one [military] strike wey bin target Pakistan and 2024 say dem dey tok bad tins about di Muslim community,” Seema Chishti tok. “So… to dey rejected nationally dey significant.”

One of di BJP major campaign promises na to bring one single personal law, or one Uniform Civil Code (UCC), for all citizens no matter dia religion.

Modi raise one hand while e dey tok for one election campaign rally, for New Delhi, India

Reuters
Di Indian prime minister bin target di kontri Muslim minority during im campaign

Wen e come to matters like marriage, divorce, inheritance and adoption, India get different laws for different communities based on dia religion, faith and beliefs.

One UCC don dey resisted by di minority communities wey fear say dem go force dem to really alter dia customs and traditions and di way dem dey live.

So dem go fit bring in one UCC nationally, Oga Modi go now need di support of im allies so im go push vote through.

E neva clear yet wetin di oda parties for im alliance think about di proposal – and while India no dey new to coalition goments, dem don dey prone to instability for di past.

How one coalition goment dey affect life for India?

During di BJP previous term, many opposition parties bin complain say dem no dey able to effectively govern di states wia dem dey find power sake of di BJP-ruled federal goment dey withhold funds wey dey due to dem.

Dis include funds for disaster relief, to build infrastructure projects and to pay for national rural employment guarantee scheme.

Dis regional parties dey hope say dia gain for dis elections fit increase dia bargaining power and help deliver better to dia people.

As dem dey prepare to begin third term, di BJP fit likely push for law wey don dey criticised sake of say e fit lead goment control and over-regulation of di broadcast and digital media.

Mainstream media for India don dey accused say dem dey ansa to goment, for di mercy of big corporations, and dey too afraid to kwesion di goment.

But Oga Yadav dey hope say di BJP dey lose im majority fit ease those pressures: “I hope say di media go wake up and find dia voice.”

Source