Kontri wey you fit repair phones, laptops, oda electrical appliances for free

Pesin wey dey fix laptop

BBC

Shey your electric kettle, laptop or phone don spoil?

Well if you dey stay for Austria, di goment go pay up to €200 ($219; £173) so you go fit fix am.

Dem make di Repair Bonus voucher scheme to try get more pipo to stop dey troway dia old electrical appliances and focus to fix am instead.

Erik laptop don break so e go one computer and phone repair shop for Vienna. Sake of say di scheme na only half of di moni to fix am e go need pay.

E say, “Na old laptop and I bin dey try make am work again instead of to buy new one”

Erik don use di Repair Bonus to fix one old CD player, wey don dey work well now. E say di scheme make am easy to decide to fix tins or troway dem.

E say, “E help becos for pipo to fix tins e dey cost pass dan just to buy new one. Dis way tins fit dey saved.”

For di back of di workshop, Lucas dey work on di motherboard of one old laptop. Around am na boxes of computers and phones wey pipo carry come for repairs.

Di oga of di repair company, Helferline, Clemens Schmidgruber say di scheme don do beta for im business.

E say, “our moni don double since e start so we dey happy about am.”

Oga Schmidgruber say di way di scheme dey work na customers go download di voucher from goment website and dem go pay di repair shop complete moni. Den in three to four weeks, you go get back half of di moni.

Na Covid Recovery Fund di Austrian goment dey take fund di scheme and na just for electrical appliances.

But di City of Vienna get anoda scheme wey dey work like dat but na to repair old clothes, bicycles or furniture.

Markus Piringer wey dey organise di Repair Network for Vienna say, “If di price to repair dey like 20-30% more dan wetin e go cost to buy new one, pipo go normally buy new. As di Repair Bonus dey low dis costs, e go make pipo to wan repair more”.

Bike repair pesin

BBC
Austria capital Vienna get anoda program to repair clothes, furniture and bicycles

Markis say na to change di policies and mindsets.

“For some pipo e still make sense to have di newest tins and troway clothes afta half a year or even less. So na somtin wey need awareness.”

And e warn say as di repairs program dey work wella for Austria, technicians and craft pipo no reach to do di work.

For im bicycle shop for Vienna, Marc Warnaar and im team dey fix one bike, wey get rusted brake and gear cables.

“Dem no dey make spare parts for dis gear system,” e tok, “Especially di gear cables, you no fit buy dem anymore. So wetin we go do na to exchange dem wit a newer model, so e go run again.”

E tok say di Vienna Repair voucher don make big difference to im business.

“Normally we dey see large decline in repairs, especially for winter. But now we dey see lot of pipo dey come sake of dis voucher and dem dey get dia bikes repaired also for winter. Yeah, e don dey good for us.”

Source