President George Weah and rival dey in close race as Liberia election joinbodi dey announce results

George Weah and Joseph Boakai

BBC

Liberia President George Weah and di opposition candidate Joseph Boakai dey for very tight race for di presidential election result, as almost three-quarters of di vote results don dey announced.

Di kontri National Elections Commission bin announce on Sunday say na about 73% of di votes don enta and oga Weah dey lead narrowly wit 43.8% against oga Boakai wey get 43.5%.

As at Sunday, di commission don announce results from 4,295 polling units out of di 5,890 polling units wey dey di kontri.

Di announcement dey come as di West African regional bloc Ecowas sama warning against declaration of “premature” victories.

Di bloc all say make all parties uphold peace as dem await di results, adding that they would be held accountable for any actions that could lead to violence and instability.

President Weah wan run for second term for office.

Oga Boakai, wey come second for di last elections, na di deputy to Ellen Johnson Sirleaf wen she be president.

Di winner must get at least 50% of di vote to avoid a run-off elections.

Liberians bin go polls on 10 October to elect di president, members of di House of Representatives and half di Senate.

Voters

BBC

Wetin go happun if none of di candidate get 50% of di vote

Di election go enta run-off if none of di candidate get more dan 50%.

Di electoral body get 15 days from di date of di election to announce di final results.

If no clear winner show, run-off go hold on 7 November.

For 2017, di presidential election bin enta run-off. Oga Weah, wey be former football star bin get 38.4% of di vote and Boakai bin get 28.8% – none of dem get di 50% wey dey required by law to win di presidency afta di first round of voting.

Oga Weah later win di 2017 run-off wit 61.5% to Mr Boakai 38.5%.

Liberia National Electoral Commission

Reuters
Di electoral commission don announce results from 73% of di votes

More dan 2.4 million Liberians, many of dem first-time voters wey dem born afta 1989-2003 civil wars, bin register to elect di president, members of di House of Representatives and half di Senate.

Na 19 candidates wey include women dey run for di office of president against oga Weah.

Weah bin take ova power for di first elected female president for Africa, Ellen Johnson Sirleaf, afta she finish her two terms for 2018.

Local and regional election observers report peaceful polls and high turnout across di kontri, but mention problems like voting delays for some polling stations.

Despite di slow announcement of results, di West African regional bloc Ecowas, of which Liberia na member, don ask Liberians to “continue to exercise maximum patient as dem dey wait for official provisional results”.

Ecowas also tok say dem dey aware of “attempts by some Liberian stakeholders to declare premature victories or put undue pressure on di National Elections Commission”.

Dem warn say dem go hold such groups “accountable for any actions wey fit lead to violence and instability”.

Liberia still dey recover from brutal civil wars wey end two decades ago, wey lead to di death of an estimated 250,000 pipo.

Analysts tok say dis fit be di last attempt at di presidency for 78-year-old Mr Boakai.

Mr Boakai, na former vice-president, e carry out im campaign under di slogan “Rescue”, e argue say di West African state don go downhill during Mr Weah first six years for office.

Oga Weah wey be 57-year-old don dismiss Mr Boakai claims, e say im don make ogbonge improvements for im first term, wey include introducing free tuition for university students.

Di secretary general of Mr Weah ruling Coalition for Democratic Change (CDC) party, Jefferson Koijee, last week bin rull out di possibility say oga Weah go lose, but tok say di president go accept di result because “di peace of dis kontri dey above im own”.

Source