Solo driver Pelumi Nubi land for lagos afta 10,000km drive from London

Social media influencer Pelumi Nubi don land Lagos, Nigeria comercial capital afta wetin be like long and difficult journey from London by road.

Pelumi wey drive 10,000km from London arrive for Lagos on Sunday to di reception of many Nigerians wey welcome her back.

She bin embark on a solo road trip from January 2024 wey go make her cross ova 17 kontris bifor she go enta Nigeria and na her own way to break barriers and redefine boundaries as a woman.

On 25 March 2024, Nubi bin post for her Instagram page say she don get accident wit her small car for Liberia wey she don dey use cross different kontris from London.

For di video, e show say di side of di car don destroy and e go take time to repair.

Di video show say dem rush her go hospital for inside ambulance and medical pipo dey attend to her.

Di car damage go slow down her journey wey suppose end by March but she survive di accident afta di bumper and windscreen bin destroy for di accident.

Many bin tink say her journey don end wen afta dat accident but di determined traveller kontinu her waka.

For one interview wit local media, di travel content creator tok say she bin dey make dat kain journey to give odas di opportunity say dat kain travel from Lagos to London dey possible and “e go inspire next generations of travellers to step out of dia comfort zone.”

Nubi wey don travel to ova 80 kontris of di world before bin tok say she make correct preparations wey include to know di safest routes, policies and cost of di journey.

Her last video update na from Liberia.

Meanwhile, for di video wey she post for her Instagram about di accident, na Ivory Coast bin dey di location.

London to Lagos, Pelumi Nubi journey

Na on 31 January 2024 she start her journey from London and na France she first go wit her small car wey get different items wey include kitchen and bed wey she go need for road.

Pelumi Nubi use ferry transport across di rivers wey dey road till she enta Paris den she cross go Barcelona for Spain on 4 February 2024 before driving to Malaga.

By 10 February, Nubi di traveller enta Morocco afta dem place her and di car for ferry at di price of €115 so as to cross di sea. Morocco na di first African kontri she enta since she begin her journey from London by road.

She spend about £295 (N501,333) for fuel wey carry her from UK reach Morocco.

Before she drive enta Sahara Desert, she bin get eye problem and she quickly find one clinic to do treatment on 18 February.

By 20 February, she cross enta Sahara Desert and den pass di border into Mauritania.

E take 23 days and 6,967 kilometres for Pelumi Nubi to travel by road reach Mauritania, den by 2 March, she enta Senegal.

On 8 March, she cross enta Gambia through ferry and by 13 March, she enta Guinea Bissau wia she also do checking for her car afta di dangerous roads wey she drive through.

Wen she bin wan cross enta Sierra Leone on 19 March, dem no allow her becos say her car na ‘right hand drive’. She begin dey cry as she wait and hope say dem go release her and let enta di kontri. Dem finally allow her afta some border officer step in to help her.

Becos of di delay, her arrival for Nigeria wey suppose be on di 23 March bin shift go 7 April 2024.

She lament say to cross west African kontris na her hardest and worst experience- dis na sake of say dem no allow her access into Liberia on 24 March.

She sleep for Liberia border afta she chop some cold garri and dey wait for miracle to allow her enta di kontri.

Dem finally allow her enta Liberia on 25 March afta wey she don taya and dey frustrated. Na di Nigeria embassy for Liberia help her sort di issue wen dem allow her into di kontri.

Liberia na di last kontri wey she reach before di tori of her accident.

Source