Man United vs Liverpool live updates

Man United vs Liverpool

Getty Images

Manchester United manager Erik ten Hag say players go dey “angry” wen dem face Liverpool and call on dem to “bring big games over di line”.

United bin concede twice for stoppage time for one dramatic 4-3 loss to Chelsea on Thursday, five days afta dem allow one 99th-minute equaliser for Brentford.

Doz results don leave dem sixth for di table bifor dem host Jurgen Klopp title-chasers on Sunday (15:30 BST).

“We need to step up and make better decisions,”Ten Hag tok.

Di five points United don drop late for dia past two league games don leave dia hopes to qualify for next season revamp Champions League dey hang by thread.

But Ten Hag add say: “We fit play to one very high standard. We fit compete wit di best and beat di best for di Premier League. Wen you fit do dat, you fit also do am across Europe.

“We need to learn how to bring big games over di line.”

Wit di top five for English football top flight set to earn one place for Europe elite club competition next season, United trail fifth-place Tottenham by nine points wit eight games left and dey 10 behind Aston Villa for fourth.

Dey don win for both occasions dey don face Liverpool for Old Trafford since Ten Hag bin take charge for 2022, including one rise and fall FA Cup quarter-final last month wey finish 4-3.

And di United boss tok say e want im players to use di disappointment wey dey experience for Chelsea – wen Cole Palmer bin score for di 10th and 11th minutes of injury time – to fuel one victory bid against dia old rivals.

“We need to recover very quick,” Dutchman Ten Hag tok. “We need to turn dis around. We go be for one positive mood and we go dey look forward.

“We need to take energy but we go dey mad, angry. From anger you fit take lot of energy and dat na how we need do am.”

Line -Ups

Manchester United starting 11: Onana, Wan-Bissaka, Maguire, Kambwala, Dalot

Casemiro, Mainoo, Garnacho, Bruno Fernandes, Rashford, Højlund

Liverpool starting 11: Kelleher, Bradley, Quansah, van Dijk, Robertson, Mac Allister, Endo, Szoboszlai, Salah, Núñez, Díaz

Dey refresh dis page for live updates

Source