BBNaija Nominated housemates today: Queen, Saga, Liquorose, Whitemoney, Jaypaul, Sasky and JackieB dey up for eviction

Seven housemates dey up for possible evictions dis week afta Monday evening nomination and Head of House games.

Before di head of house games na Pere, Saga, Emmanuel, Liquorose, Whitemoney, Jaypaul, Sasky and JackieB bin dey up for possible eviction..

But Biggie, give dem one opportunity to remove themselves from di list during di Head of House games.

Emmanuel and Pere na di lucky ones wey take advantage of di opportunity for di new twist wey Big Brother introduce to di game.

Emmanuel win di Head of House game and get automatic Immunity to comot for di list of nominated housemates e choose Liquorose as im deputy wey go stay wit am for di luxury louge.

While Pere wey carry second and get di Save and Replace Power, Replace himself wit Queen.

Who be di nominated housemates?

As tins be now na, Saga, Liquorose, Whitemoney, Jaypaul, Saskay, Queen and Jackie B dey up for Eviction dis Sunday.

Profiles of di nominated housemates

Roselyn AKA liquorose

She be 26 years old from Edo State.

She be popular Nigerian dancer.

She saye she don dey dance since she be 12 years old.

Roselyn say she dey bring her playful self to di competition.

Saskay

21 year old from Adamawa State.

She say she be peace loving pesin and she say she be emotional pesin. Sakay na Artiste and Model.She say she go like own her own Art gallery afta di show. Saskay dey in a relationship.

29 year old from Adamawa state.

Jackie B

She be single mother of a son and she say she come from a family of 12.

“You respect me I respect you” na her watchword.

She say she love music, dancing and having fun.

Saga

Dis 28-years-old engineer come from Lagos State. Okusaga aka Saga say im go “bring vibe to di house”.

Im say di lowest point for e life na wen im hear say e mama – wey im describe as e best friend – don die.

Whitemoney

Im say e be businessman wey dey into import of shoes.

Multitalented Whitemoney describe imself as open-minded “jolly good fellow” wey like to catch fun.

Di 29-year-old Lagos based Whitemoney originally come from Enugu State.

Jay Paul

29-years-old Jay Paul come from Calabar, Cross River state, e describe imsef as “social butterfly”.

Im be complete entertainer wey dey run tourism business. Jay Paul dey act, sing and dance as well.

How di housemates nominate:

  • Angel- Emmanuel and Saga
  • Cross- Saga and Liquorose
  • Emmanuel- Yousef and Jackie B
  • Jackie B- Pere and Saga
  • Jaypaul- Nini and Pere
  • Liquorose- Saga and Cross
  • Nini- Pere and Jaypaul
  • Pere- Angel and Whitemoney
  • Queen- Saskay and Pere
  • Saga- Jackie B and Jaypaul
  • Saskay- Whitemoney and Liquorose
  • Whitemoney- Saga and Saskay
  • Yousef- Emmanuel and Queen

So now, na only six housemates no dey up for possible eviction and dem be Angel, Yousef, Cross, Pere, Nini and Emmanuel.

At least one of di nominated housemates go leave Big Brother house on Sunday.