New national ID card – wetin e dey about, how e go work?

Nigeria goment wan launch one new national identity card wey get payment functionality for all types of social and financial services.

Na di National Identity Management Commission (NIMC) go run am.

Dis colabo na wit di Central Bank of Nigeria (CBN) and di Nigeria Inter-bank Settlement System (NIBSS), wey AfriGO, one national domestic card scheme go power, NIMC announce.

All dis one dey inside one statement wey NIMC Oga of Corporate Communications, Kayode Adegoke, release on Friday, di new card go carry plenty functions.

Di National ID card, wey dey layered wit verifiable National Identity features, dey backed by di NIMC Act No. 23 of 2007, wey order NIMC to enrol and issue one General Multipurpose card (GMPC) to Nigerians and legal residents.

Di card go address di demand for physical identification wey go make cardholders prove dia identity, access goment and private social services, NIMC tok.

E go also make am easy financial inclusion for Nigerians wey no too get, empower citizens, also encourage more participation for nation- building.

NIMC add say na only registered citizens and legal residents wey get di National Identification Number (NIN) go fit request di card.

Di card, go dey produced according to ICAO standards.

ICAO position na as di kontri default national identity card, NIMC further explain.

“Make we add to dis functionality, cardholders go also dey able to use di cards as debit or prepaid cards wen dem link same to bank accounts of dia choice.

“Di card go enable eligible pesins especially those wey dey financially excluded from social and financial services to get access to multiple goment interventions programs.

“In line wit data protection regulation and public interest, NIMC still dey committed to protect cardholders personal data and go make sure sy e match wit international standards on data security protocols as security features wey protect di confidentiality and safety of users’ informate,” di statement further tok

Ogbonge features of di card

Here na tins wey di nw card go fit do acording to Nimc:

  • Machine-readable Zone (MRZ) wey go wit ICAO for e-passport informate.
  • Identity card Issue Date and document number in line wit ICAO standard.
  • Travel, health insurance informate, microloans, agriculture, food stamps, transport, and energy subsidies, among others.
  • Nigeria quick response code (NQR) wey carry di national identification number.
  • Biometric authentication, like fingerprint and pictures, as di primary medium for identity verification through di data wey dey di card chip.
  • Offline capability wey allow transactions for areas wit limited network coverage or zero infrastructure connectivity.
  • Functionality as debit and prepaid card wey go cater to both banked and unbanked pesin go be part of di features of di card.

Di request for cards by registered citizens and legal residents go dey available online, for any commercial bank, various agencies or agents wey dey participate for multiple programs and/or any of dia offices nationwide, NIMC tok.

For August 13, 2020, den Nigeria Minister of Interior, Rauf Aregbesola, bin announce say goment don begin process to join data of Nigerians together for one place wit di use of di National Identification Number (NIN).

Di informate na after di minister president report of di “Committee on Citizen Data Management and Harmonization to former President Muhammadu Buhari.

Di report na move to address issue wey make di US goment put restriction of visa for Nigerians. One of di recommendation of committee wey put di report togeda na di use of NIN to make sure say goment fit collect data of everyone and keep togeda for one place.

Source