‘A time to heal’ – Moyo Lawal tok about her sex video wey leak

Celebrities, influencers and plenty fans of Nigerian actress Moyo Lawal don come out to hail her afta she tok say she still dey strong, stand gidigba and she neva lost her faith.

Moyo lawal na Nigerian actress wey act don act inside plenty Nigerian movies.

Ms Lawal bin make headlines wen her private video bin go viral on social media for recently.

Although she bin don tok say she dey plan to take legal action against her whoever leak di tape.

She identify say di man wey bin dey di video wit her na her ex-fiancé.

For one new post on her verified Instagram account wey she title ‘A time to Heal’, di actress bin shed more light on life afta her sex video wey leak.

Nollywood actors like Kate Henshaw, Omoni Oboli, Empress Njamah, Adeniyi Johnson, Tayo Odueke, among odas express support and solidarity for di actress.

“Until a lioness tell her story , every hunter go continue to be a hero . Pipo always take quiet, non problematic pipo as fools . However, I think say na time for me to start talking.

I wan tok say dis video wey I bin do wit my ex, wey I bin warn marry dat time no be for public consumption, and im unauthorized distribution na breach of my personal boundaries. However dis criminal breach of privacy go dey treated wit legal action.”

‘I no release di video to public’

Ms Lawal say no be she leak di video.

“One thing .. wey I fit tell you for a fact however na say tins no dey appear like dem be. I only get xxx twice last year, one of those times na di video.”

She add say recording di video na wit her consent and she deny tori wey dey spread say na she release di video to di public.

Lawal tok say di man for di video na her fiancé wey dem bin dey plan to marry but dem later break up sake of communication challenges.

Plus dem record di video wen she bin dey sick.

“He no dey live for Nigeria, e put in plenty work before e win my trust over di years. We bin dey work towards getting a house, marriage and all dat, and we break up. I dey put my entire life on pause wit any man wey I dey date”

She add say she be private pesin wey no like wahala plus she no be dat kain girl.

“I don turn down so many dates offers, I sleep alone 90% of my entire adult life, I choose to dey alone, to come get one ugly video wey happun wen I dey sick dey hang ova her head.” She tok.

On life afta di sex video leak, Ms Lawal tok say she neva lose her faith and she still dey stand gidigba.

Dis no be di first time wey Nigerian celebrity sex video dey leak recently.

For October 2021, popular Afrobeat music star, Tiwatope Savage, wey pipo sabi as Tiwa Savage, bin dey news f on top her sex video wey leak online.

Di singer wey break di news of di sex tape herself bin claim say pesin dey blackmail her sake of di sex tape.

Also, Nigerian singer, Ikuforiji Olaitan, alias Oxlade bin also experience am for February 2022 wen e mistakenly upload im private video on Snapchat.

Although e delete am almost immediately, but some of im friends don already see and record am, dem later share am on top social media.

Oxlade bin later tok sorry to im fans ova di development, and tok say na mata of betrayal.

Nigerian crossdresser, James Chukwueze Obialor, wey pipo know as James Brown, bin set di internet on fire afta im sexual intimacy video wit one lady bin go viral for October 2022.

Di private video bin leak on Snapchat.

Source