Who be Omotola Odeyemi di new postmaster general wey her appointment cause drama for NIPOST

Di new Chief Executive Officer (CEO) of Nigeria Postal Service (NIPOST), Omotola Odeyemi, don resume office for di agency headquarters for Abuja.

Odeyemi wey be di first woman to head Nipost as im CEO, resume work on Monday around 1pm by meeting wit top directors for di agency.

Last week, President Bola Tinubu bin sack Adeyemi Adepoju as Nipost CEO, come appoint Odeyemi.

Her appointment cause di workers of di postal service to protest.

Nipost staff begin protest on Monday morning, close down di head office for Abuja, Nigeria capital as dem provoke say dem dey against Omotola Odeyemi appointment.

Di workers say dem bin dey protest say Tinubu remove dia former oga, wey dem say bin introduce plenty beta changes less dan one year wey im enta office.

Di president of di National Union of Postal and Telecommunication Employees, Buba Nehemiah say, dis new appointment no go favour di staff at all.

Nehemiah say dem no dey against di president but e go fine to allow Sunday Adepoju to continue di beta work wey im bin don start.

“To remove am at dis point go end di process and e go take Nipost back to square one wey we dey against,” im tok.

Omotola Odeyemi biography

Omotola or Tola as dem dey mainly call her, na public policy professional.

She study electrical and systems engineering from George Washington University.

Her first degree na for electrical electronics and communication engineering from Morgan State University.

According to her CV, she don hold positions for both goment and private sector andget over 15 years experience for di strategic implement frameworks for public sector, technology projects and infrastructure financing.

She work as di west Africa head of goment relations for di biggest cryptocurrency exchange for di world.

She don head public policy for ride hailing company Uber for West Africa.

Tola also work in different positions for di Lagos state goment for di early days of her career.

Source