Oluwo of Iwo new wife: Queen Firdaus of Iwo town, di Kano princess turn Yoruba king wife

Oluwo of Iwo, Oba Abdulrosheed Akanbi marry a princess of di royal family of Kano on Saturday.

Dis wedding dey historic because di Madaki family, a royal for Kano Hausa land give out dia daughter in marriage to another kingdom for far away Youruba land.

Di new Iwo queen na di daughter of late Madakin Kano, Abdullahi Sarki Sani Yola.

Princess Firdauz Abdullahi [now “Queen Firdaus of Iwoland”] na di granddaughter of di late Emir of Kano Ado Bayero.

Oluwo of Iwo new wife: Queen Firdaus of Iwo town, di Kano princess turn Yoruba king wife

BBC
Oba Abdulrasheed Adewale Akanbi Ilufemiloye Telu 1 na di 16th pesin to become di Oluwo of Iwoland

Di wedding bin take place for Madakin residence for Kano around 11am on 19 March, 2022.

Reception bin follow for di palace of di Emir of Kano, Alhaji Aminu Ado Bayero around 4pm.

Oluwo of Iwo on Saturday reveal di identity of im newly married wife inside new fotos.

Oluwo of Iwo new wife Queen Firdaus of Iwo town fotos

Di Osun State monarch release beautiful fotos of di new queen with a short message wey read, ‘Queen Firdaus of Iwoland’.

Di wedding of di Oluwo to Firdaus bin dey happun for Kano wen di king release di fotos.

Queen Firdaus of Iwoland profile

Di bride, Firdaus Abdullahi be 27-year-old.

Di he Palace of Emperor Telu I of Greater Iwo Empire on Saturday name her “Queen Firdaus” of Iwoland.

Firdaus means Paradise and she go noe get title as Telu1 Alase Lori Orisa 1 Arole Olodumare 1.

She hold a diploma in catering from di School of Management Studies, Kano.

Like oda children in di Kano royal family, she get Qur’anic knowledge.

She dey brought up in di palace of di Emir of Kano and di domot Madakin Kano.

Oluwo first marriage bin crash

Dis no be di first time Oba Abdulrosheed Akanbi go dey do wedding.

Di traditional ruler bin marry one woman from Jamainca wey her name be Chanel Chin.

But dia marriage crash afta Chanel born one pikin for Oluwo of Iwo.

Chanel tell tori pipo and social media say she no dey happy inside di marriage wit di traditional ruler.

She also tok say she no get rest of mind for im house.

Oluwo of Iwoland Oba Abdulrasheed Adewale Akanbi profile

Oba Abdulrasheed Adewale Akanbi Ilufemiloye Telu 1 na di 16th pesin to become di Oluwo of Iwoland

Dem born am on 21 June, 1967 to di family of late Prince Kola Akanbi of Molasan Compound, Gbaase Ruling House, Iwo, Osun State for South West Nigeria.

Oba Abdulrasheed become di Oluwo of Iwo for November 2015 wen im be 48 years.

Since im become King, plenti controversies don surround am

Popularly for Yorubaland, na Kings dey wear crown but Oba Abdulrasheed allow im former wife, Queen Chanel Chin to wear crown like King.

Plenti pipo criticise am say e no dey right for Queen to dey wear am but im tell tori pipo say di pipo wey dey bad mouth am no sabi culture.

“Di first queen of Oduduwa (first Yoruba king), Olokun dey wear crown. Any king from di lineage of Oduduwa suppose allow im Queen to wear crown,” im tok.

For December 2019, Oba Akanbi release press statement to inform pipo say im don divorce im wife.

For di statement e say “Sake of personal differences wey we no fit reconcile, Chanel Chin no be im Majesty Queen again.

“We ask di public make dem no do any business transaction with her or make any request dey use her office as Queen, We wish her all di best for her new joni.”