Tupac family speak afta authorities charge one former gang leader in connection to im murder for 1996

Tupac

Getty Images

Di charge of a former gang leader with di murder of Tupac Shakur for 1996 na “ogbonge moment”, na so di late rapper sister don tok.

On Friday, Nevada grand jury indict Duane “Keffe D” Davis, 60, on one count of murder with a deadly weapon.

Sekyiwa Shakur respond say “today na victory” but “reserved judgement” until legal proceedings don complete.

“E dey important to me say di world, di kontri, di justice system, and our pipo acknowledge di seriousness of di passing of dis man, my brother, my mama son, my papa son,” she post ontop Instagram.

“Plenti hands don dey involved and plenti tins remain surrounding di life and death of my brother Tupac and our Shakur family overall. We want real justice, on all fronts,” she continue.

Tupac murder: Three tins we sabi afta Keffe D arrest
The British Broadcasting Corporation

Her tok dey come afta police for Las Vegas bin arrest Davis afta di murder nearly three decades ago.

For court, prosecutor Marc DiaGiacomo describe Mr Davis – a former leader of di South Side Compton Crips street gang – as di “on-ground, on-site commander” wey “order di death” of Shakur.

For one news conference later on Friday, police officer Jason Johansson say e become obvious very quickly say dis na a gang-related crime, and dem don review di case plenti times.

But no be until 2018, wen new information come to light, na im di case get ginger.

Mr Johansson also mention Mr Davis “own admissions” to media outlets say e bin dey di vehicle wia dem fire di shots from.

Tupac Shakur: Wetin di police don find out about Keffe D?
The British Broadcasting Corporation

Dem bin shoot di hip-hop legend fours times for one drive by-shooting inside Las Vegas for 1996.

Shakur, wey be one of hip-hop most acclaimed rappers bin dey only 25 years wen im die.

Im die on 13 September 1996, a week afta dem shoot am four times inside im car wen im dey wait for red light.

Di death of di rapper, one of di ogbone hip-hop pesin, don inspire several documentaries.

Shakur, wey im stage name na 2Pac, release im first album for 1991.

Shakur bin sell more dan 75 million records worldwide, im bin dey enjoy chart success wit hits including California Love, All Eyez On Me and Changes.

For June dis year di rapper receive one posthumous star for di Hollywood Walk of Fame.

Tupac Shakur

Getty Images
Police for Las Vegas still dey investigate Tupac Shakur death for one drive-by shooting wey happun for 1996

Source