Abia State Governorship election result 2023: Live Inec updates as INEC declare Alex Otti Abia state governor elect beating Okechukwu Ahiwe of PDP and odas

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don declare Alex Otti of di Labour Party winner of di Abia state governorship election.

Di State returning officer Professor Nnenna Oti, make di declaration for di Inec secretariat, Umuahia on Wednesday – four days afta di election wey bin hold on 18 March.

According to Inec, Otti poll 175,467 to beat im closest challenger Okey Ahiwe of di Peoples Democratic Party wey poll 88,529.

Di state returning officer make di final declaration afta collating di result of Obingwa Local goment wey bin dey delay di final announcement.

As at Monday 20 March Inec bin don collate results from 16 out of di 17 local government areas of di state apart from Obingwa.

On Wednesday di Returning officer of Obingwa LGA declare di result as; LP – 3776, PDP – 9962, YPP – 3101.

Abia State Governorship Election Result 2023

LP – 175,467

PDP – 88,529

YPP – 28,972

Wetin bin happun for Obingwa Local government area

From di results wey Inec don collate; Abia North, Abia South, Arochukwu, Bende, Ikwuano, Isuikwuato, Ohafia, Umuahia North, Umuahia South and Umunneochi na di 10 LGAs wey LP don win.

Di PDP candidate on im part don Isiala-Ngwa South, Ukwa East, Ukwa West, Ugwunagbo, and Isiala-Ngwa North, according to Inec.

Di YPP candidate, Eyinnaya Nwafor win only Osisoma LGA – wia im come from.

All di parties now dey wait for di result of Obingwa LGA wey get 157, 390 registered voters, according to Inec data.

Out of dis 157, 390 na only 154, 966 voters collect dia Permanent Voters Cards for di 2023 election.

On Sunday, Inec raise alarm say jaguda pipo don attack di collation centre for Obingwa wey dey happun for council secretariat.

Tori be say some politicians dey try do mago-mago wit di result for Obingwa wey fit determine di winner of di governorship election.

To save di situation Inec announce suspension of di collation of di result for Abia state.

As tins be, Abia pipo dey wait to hear form Inec on dia decision wey dem don take on di governorship election result for Obingwa Local goment area.

Who be Alex Otti?

Alex Otti na Nigerian economist, banker, investor, philanthropist and politician.

Im be former Group Managing Director of former Diamond Bank Plc.

Im also be former govnorship candidate of Abia State under di All Progressives Grand Alliance (APGA)

Court of Appeal bin name am winner of Abia govnorship election for 2015 only for less dan two months later, for Supreme court to reverse am.

Move around di map to see di results local goment by local goment as Inec declare am

Na here you go see di complete results from di 28 states wen Inec begin declare dem