Babajide Sanwo-Olu win Lagos state governorship election 2023 as e beat Gbadebo Rhodes-Vivour of Labour Party and odas

Di Independent National Electoral Commission, Inec, don return Govnor Babajide Sanwo-Olu of di All Progressives Congress, APC, as di winner of Lagos state govnorship poll.

E poll a total of 762,134 to beat im closest rival Gbadebo Rhodes-Vivour of LP wey get 312,329 votes.

Millions of Nigerians vote for wetin some sabi pipo say be di most competitive general elections since military rule end.

Nigerians vote to elect govnors and also lawmakers into di state house of assemblies.

Na 18 political parties participate for di polls and unlike di presidential election, na only 28 out of di 36 states of di federation participate.

But asides di govnorship election wey happun for 28 states, elections for members of state assembly happun for all di 36 states of di kontri.

According to di Independent National Electoral Commission, Inec, 993 State Houses of Assembly seats na im dey up for grabs.

Na 20 local goment areas dey Lagos state wey be di commercial capital of Nigeria.

Who be Babajide Sanwo-Olu?

Babajide Sanwo-Olu become di 15th govnor of Lagos afta im win di March 9, 2019 election.

Di 57-year-old politician wey dem born for Lagos bin don dey for inside public service for di state since 2004.

Im work as Special Adviser on corporate mata to di govnor and deputy as well as Commissioner of Commerce and Industry.

Im bin dey campaign with di tok of “Greater Lagos Arising” wey claim say im second term go help am complete all di di projects im don start for Lagos.

Move around di map to see di results local goment by local goment

Na here you go see di complete results from di 28 states wen Inec begin declare dem