Tributes pour in for Pastor Taiwo Odukoya of Fountain of life church

Tributes don begin pour in for di founder of Fountain of Life church, Pastor Taiwo Odukoya wey di.

Di church for official statement say di pastor die on Monday, 7 August, for di United States.

Di statement wey dem release on Tuesday say ”we dey in total submission to you Lord”.

Pastor Odukoya na one of di Christian leaders wey many millennials grow up to listen to via im gospel television shows.

Di death of im first first wife, Pastor Bimbo Odukoya, a life coach – wey die for plane crash for 2005 bin attract global reaction.

Pastor Odukoya lose im second wife, Pastor Nomthi to cancer for 2021 after dem bin marry for 11 years. Dem both get two pikin dem.

Di death founder of Fountain of Life church, wey be 67 years don see many pipo dey eulogise am.

Tributes to Pastor Taiwo Odukoya

From professionals, to politicians and clergy – many don pay tribute to am and dem dey remember how im preaching dey always touch dem for body.

Lagos State governor, Babajide Sanwo-Olu send im condolences to di family of di late Pastor Taiwo Odukoya.

Sanwo-Olu for social media post say “na wit utter shock and sadness wey I receive di news of di passing of Pastor Daniel Taiwo Odukoya, di founding Pastor of The Fountain of Life Church.

“Pastor Odukoya na dear brother and friend. Im na dedicated man of God wey im faith and belief in God never shake or reduce despite experiencing di obstacles of life.”

Pastor Odukoya biography

Dem born Taiwo Odukoya for Kaduna state northern, Nigeria.

Na dia im bin start school bifo e later get higher education for University of Ibadan to study petroleum engineering.

Pastor Taiwo marry di late pastor Bimbo Odukoya and get three pikin wit her.

One of di pikin wey dem get together na Jimmy Odukoya wey play ‘Oba’ for di popular movie ‘di Woman King’.

For December 2005, Bimbo Odukoya, plus over one hundred oda pipo bin die for plane crash for one Sosoliso Airlines Flight.

Na Pastor Taiwo and im first wife Bimbo Odukoya bin join bodi to form di Fountain of Life Church for 1992 wit better plans of how dem go change life wit di ministry.

For 2014, nine years after di first wife Pastor Bimbo Odukoya bin die, Pastor Taiwo bin query di investigation of wetin bin cause di plane crash wey take di life of im former wife.

Na den e say e dey okay for pastors to get dia own private Jets sake of e dey help dia work. E say im wife for still dey alive if to say she get private jet