Dr Isa Ali Pantami: Nigeria minister of communications & digital economy profile

"Isa Ali Pantami [Boko Haram]"

BBC
Dr Isa Ali Pantami

Ali Isa Pantami, Nigeria minister of communications and digital economy don turn pesin of interest for di west African kontri.

Tori be say over di last few days many pipo dey interested to know more about Dr Pantami based on wetin dey on ground.

Dis na some facts about di minister and former boss for NITDA – [National Information Technology Development Agency], wey many pipo no know.

Nigerians call for Isa Ali Pantami resignation

Tori be say over di last few days many pipo dey Nigerians for social media dey call for di resignation of di minister

Di main opposition party inside Nigeria (PDP) don join di list of groups wey dey call for di resignation or sack of oga Pantami.

E chop accuse say him make statements in di past in support of terrorist groups such as Al-Qaeda and Taliban.

But di goment minister, don deny any links wit terror groups and dey threaten legal action ontop di allegations.

Dr Isa Ali Pantami na Imam for over 20 years

For two decades now, Pantami don be imam wey dey lead prayers for mosque starting from im time as graduate assistant for Abubakar Tafawa Balewa University for Bauchi state wey dey northeastern Nigeria.

As pesin wey dey learned and dey preach about islam, di next natural step na mostly to become imam wey go dey lead muslims for prayer and dat na di step wey Pantami take.

And na something wey e dey continue to do for many mosques including the popular Al Mannar mosque for Abuja wia na im be chief imam till tomorrow.

Anoda thing be say being a minister no make am stop di annual tafsir teaching during Ramadan fasting as even dis year e dey use im evenings to teach Quranic meanings for Al Mannar mosque for Abuja.

Dr Isa Ali Pantami efforts for North East

Anoda thing be say di minister dey really worried about events for northeastern Nigeria over di last decade.

In terms of Boko Haram and oda things wey dey happun dis na wetin make di minister dey play vital role to helep displaced pipo and bring lasting peace.

Pesin wey know am wella tok say di kain efforts wey Pantami put for north east no be small but na pesin wey no like to dey blow im trumpet na why many no know.

Schooled by Uthaymin- During Pantami’s schooling for Saudi Arabia one of di clerics wey teach according to Wikipedia na Muhammad Inn Uthaymin wey some dey call ‘a giant of islam’ based on im sabiness.

Uthaymin na one of di clerics wey oppose women driving for Saudi Arabia because according to am e go increase mixing of males and females for traffic lights, petrol station and police check points.

"Dr Isa Ali Pantami"

BBC

[Dr Isa Ali Pantami] girl pikin death

On di 23rd of November last year di minister lose im 13 year old daughter Aisha Isa pantami after brief illness.

At di time, di minister tweet “From God we come and to him we will return. My 13 year old daughter Aisha Isa Ali passed away just a moment ago.”

Dem bury her di following day after funeral prayer for Abuja central mosque.

Pesin wey sabi di minister say Amal as e nickname di child dey close to di minister wella and her death pain am wella.

Isa Ali Pantami bin serve as DG of NITDA

Di 48 year old PhD holder bin serve as director general of di National Information Technology Development Agency until 2019 wen e become minister.