Ahmed Usman-Ododo: Wetin you suppose know about di new Kogi state govnor-elect

Afta very long hours of voting and collation of results for Kogi state, di Independent National Electoral Commission (INEC) finally announce candidate of di All Progressives Congress (APC) Ahmed Usman-Ododo as winner.

Ododo win with 446,237 votes while im closest rival Murtala Ajaka wey dey represent di Social Democratic Party (SDP) poll 259, 052 and Dino Melaye of di Peoples Democratic Party, PDP get 46,362.

Usman-Ododo na di govnor-elect for Kogi state afta beating all im opponents for di 2023 Kogi govanorship election.

No be plenti pipo really sabi Usman-Ododo before im contest for di APC primaries for di state, but surprisingly e win oda aspirants to become di flagbearer.

Usman-Ododo bin beat Shaibu Audu, Stephen Ochen, Sanusi Ohiare, and even Smart Adeyemi for di APC Kogi govnorship primary election to emerge candidate of di party.

Di party adopt direct mode of election and Usman-Ododo score 78,704, Audu poll 763, Ochen get 552, Ohiare score 424, while Adeyemi poll 311 votes.

For Usman-Ododo to get space contest wella for di primary election, Kogi state deputy govnor, Edward Onoja, and even di Chief of Staff to di outgoing govnor, Pharm. Mohammed Asuku, bin withdraw from di race.

Na Govnor Bello Matawalle of Zamfara State wey don become minister for di kontri na im be di chairman of di Kogi State APC Primary Election Committee while Hon. Patrick Obahiagbon serve as di secretary of di committee.

On di 14 day of April, 2023, Hon Obahiagbon bin declare Usman-Ododo as winner of di APC Kogi state primary election.

Wetin dey clear and obvious be say Usman-Ododo na preferred candidate of di outgoing govnor of di state Yahaya Bello.

For many pipo wey no too know, Usman-Ododo wey be di APC candidate na di former Auditor-General for Kogi State. Im come from di Ebira clan of Okene for Kogi state.

Im graduate from Ahmadu Bello University for Zaria wit degree for Accounting.

According to tori wey we gather, im political strength begin dey build up for Kogi wen e enta di Internal Revenue Service under Yahaya Bello administration.

Usman-Ododo na one time member of di Nigerian Youth Parliament, one time Special Assistant to di Govnor, and im don serve as di Chairman of di Kogi State Youth Council.

Usman-Ododo get Bachelor degree for Accounting from Ahmadu Bello University, Zaria, e get Master degree for Business Administration (MBA) and na Certified Public Accountant (CPA).

Some of di ogbonge candidates wey contest wit Ahmed Usman-Ododo na Senator Dino Melaye of di Peoples Democratic Party (PDP), Adejo Okeme of di Labour Party (LP) and Murtala Ajaka of di Social Democratic Party (SDP).

As Melaye dey popular reach, pipo bin expect say im go pull im weight for di state, but dat one no happun.

Move around di map to see how Ahmed Usman-Ododo win

‘I pledge to serve wit accountability’- Ahmed Usman Ododo

Reacting to Inec announcement, Ahmed Usman-Ododo reveal say e go serve di state wit accountability.

Usman-Ododo tok for one live appearance wey im do for Sunday night wia pipo bin gather round to congratulate am for di new victory.

Di govnor-elect call on all im opponents make dem come join am to build di state.

“I dey call on my opponents to come join me to build di state sake of say we no get any oda state,” Usman-Ododo tok.

While referring to di outgoing govnor of di state Yahaya Bello, di new govnor-elect tok say na ‘critical stakeholder’ im be for di state.

“You no dey go house, your work just start. You be critical stakeholder wey fit organise any meeting for di state,” di govnor-elect tell Govnor Bello

Im add say ‘di pipo of Kogi don speak, dem don speak make Ajaokuta revive and also di issue of security go dey addressed.

Usman-Ododo appreciate President Bola Tinubu and di entire APC for di hope wey dem get for am to contest for di election.

“I extend appreciation to Inec and all stakeholders wey play key role to ensure a free and fair election,” di govnor-elect tok.

Source