President Tinubu sign N70,000 new minimum wage into law

Nigeria President Bola Tinubu don sign di N70,000 Naira minimum wage bill into law. E sign di bill on Monday for Abuja, Nigeria capital for middle of di Federal Executive Council meeting afta di National Assembly pass di bill.

E mean say e don become law for Nigeria say di lowest worker, domestic staff and odas no suppose earn below N70,000 naira.

According to Bayo Onaguga post for social media, di Head of Service for Nigeria say di new law go reassure di workers say di President cares about dia welfare.

Senate President Godswill Akpabio lead National Assembly leaders go di signing ceremony.

President Tinubu thank di National Assembly as dem pass am to law sharp sharp.

Dis dey come afta plenti dragging of leg between goment, labour unions, and di organised private sector for Abuja, as to wetin di new minimum wage suppose be in di face of di high cost of living for di kontri.

Samoa Agreement: No LGBTQ condition or $150bn deal for Nigeria, BBC find

Nelfund student loan: How to apply, how much you fit get – Answers to questions pipo dey ask as FG start to pay

Tinubu approve 70,000 naira as new minimum wage

We dey update dis tori

Source