US election update: Electoral College vote Joe Biden winner of election against Donald Trump

Joe Biden says US democracy proved to be “resilient, true and strong”
The British Broadcasting Corporation

Electoral College vote say Joe Biden, d Democratic party presidential candidate na im electors confam winner of di 3 November election.

Di confirmation wey land late Monday night na one of di steps wey dey required for Oga Biden to take office as di 46th President of di United States of America.

Under di US system, voters actually cast dia ballots for “electors”, who go in turn, formally vote for candidates weeks after di election.

Democrat Joe Biden bin win November election with 306 electoral college votes to Republican presidential candidate Donald Trump wey score 232.

Electoral college affirms Joe Biden as president-elect
The British Broadcasting Corporation

Joe Biden inside one speech after di announcement, say di US democracy don see “push, test and threat” yet e prove to be “sometin wey fit recover quickly from difficult conditions, true and strong”.

President Donald Trump, wey show no sign of accepting di result, never make any fresh comment ontop di mata [electoral college vote].

Shortly after di result [Electoral College electors officially confirm Joe Biden election victory againt Donald Trump] di America presideo announce on Twitter say Attorney General William Barr dey comot from im goment.

Barr bin tok say im get enof alias widespread evidence of voter mago-mago AKA fraud inside di election, despite di president claims.

Meanwhile Russia Presido Vladimir Putin , don congratulate Joe Biden for winning American Presidential election afta di electoral college confam am.

Putin bin don tok before say dem dey wait for di final results of di election before dem tok anytin.

[Electoral College meaning]

US election 2020: Electoral college explainer on how Trump or Biden fit win
The British Broadcasting Corporation