How South Africa dey pick dia president and oda tins to know about di 2024 election

A South Africa woman dey cast her vote for special vote

Getty Images

South Africa dey head to di polls for dia 2024 general election in May 29 and voters go get di chance to elect dia representatives.

Na about 28 million South African registered voters go get di chance to vote to elect dia representatives to di national and provincial parliaments.

Di election dey take place evri five years since 1994 and dis go be di kontri seventh democratic general election.

Wen white-minority rule bin end, di African National Congress (ANC) take ova power for South Africa.

South Africans no dey vote for a president.

Instead dem dey elect di 400 members of di National Assembly, wey go kon vote for a new head of state within 30 days of di general elections.

As a result, presidential candidates no dey, but each party leader dey front dia national campaign and dia portrait go appear on di ballot paper.

Di leader of whichever party get a majority for di National Assembly afta di election go dey expected to become di next president.

Voter dey try to see wetin dey di ballot sheet

Getty Images

Key actors for di South Africa election

  • African National Congress (ANC)- Cyril Ramaphosa
  • Democratic Alliance (DA)- John Steenhuisen
  • Economic Freedom Fighters (EFF)- Julius Malema
  • uMkhonto we Sizwe (MK)-

Di court bin stop former President Jacob Zuma from contesting di election sake of im 2021 conviction.

Di electoral commission argue say di constitution stop anyone wey don chop sentence to more dan two months for prison from serving as a lawmaker.

Dem say di Constitutional Court judges back am.

Mr Zuma dey convicted for 2021 sake of say im refuse to testify at an inquiry investigating corruption during im presidency.

Meanwhile, di current President Ramaphosa bin release Zuma from prison afta e reduce di sentencing to three month and lawyers say im fit contest as MP.

Zuma bin comot ANC to go create im own new party – uMkhonto we Sizwe (MK) wey go contest for di 2024 election.

How to vote in South Africa election

Electoral officer dey teac voters how to cast ballot

Getty Images

Di Electoral Commission Deputy Chief Electoral Officer Masego Sheburi say 62 000 officials go visit a total of 624 593 voters wia political party agents and observers go also dey available- for di special vote.

Wetin be Special vote

Di special votes for South Africa don begin already.

For South Africa, special vote dey allow a registered voter, wey no fit vote for dia voting station on Election Day, to apply to vote on a day before election day.

Na ova 1.6 million South Africans don dey approved to vote through special ballots.

Special votes bin take place on Monday and go continue on Tuesday for voters wey dey qualify.

Di voting stations for special votes dey operate from 9am to 5pm.

All special votes go dey collected and stored overnight for wia e go dey secure on 27 and 28 May.

Dem go come later transport di votes to voting stations on 29 May wia dem go open am and den add to di ordinary ballots cast on Wednesday before counting begin.

How to vote for special vote

Di Electoral Commission of South Africa (IEC) say pipo dey qualified to apply for special vote if dem meet certain conditions.

To qualify for a special vote, you need to be pesin wey no fit visit local voting station on voting day sake of pregnancy, sickness or disability wey go prevent you from going to di voting station on election day.

Voters in South Africa dey prepare to cast vote

Getty Images

How di election dey work?

Di proportion of seats wey dem allocate to parties in di 400-member National Assembly dey directly related to dia share of di vote.

For 2024, independent candidates go dey included for di first time.

Dis one mean say South Africans go cast three votes:

National parliament: One for 200 of di seats wit just political parties named on di ballot

National parliament: One for di remaining 200 seats wit different ballot paper for each of di nine provinces, listing di parties in dat region and independent candidates

Provincial assembly: One for di independent candidates or parties for di regional legislature.

Source