America actor, Johnny Wactor wey die for during car theft

Johnny Wactor

Getty Images

American actor, Johnny Wactor don die. Na tiffs wey wan tiff im car shoot am to death.

Di 37 year old, bin stop three men as dem bin dey try carry di catalytic converter comot from di motor wey im bin park.

Wactor, wey don act for di US soap opera General Hospital, bin dey pronounced dead on Saturday.

Im agent David Shaul tell Variety say im be “outstanding human being.”

E add say, “e go literally comot in shirt give you”.

Wactor mama, Scarlett tell NBC4 say her pikin bin dey go back to im car afta work, and na so e dey see pesin dey touch im car anywia.

E bin tink say dem dey tow am and no really reason say im dey in danger, e go meet am to find out wetin dey sup and na so dem shoot am, na wetin she tok.

She tell di local tori pipo say di suspect come follow di two oda men fight, and she tell dem say her pikin death dey “senseless”.

Catalytic converters na wetin di thieves dey like target for motor becos e get precious metals wey dem fit sell.

As at now, police neva arrest anybodi for di incident.

Producers wey work for di show General Hospital tok say Wactor bin dey “truly one of a kind and pleasure to work wit evri day.”

Wactor bin work for di show, General Hospital for two years as Brando Corbin.

E also act for di 2013 series, Siberia as Johnny and act for two episodes for di HBO show Westworld for 2020.

Di South Carolina born actor bin start to dey act for television for 2007, wit im role for Army Wives.

According to IMdb, e go on to act for short feem or television from 2019, wit shows like The OA and The Passenger.

E also act for di 2023 comedy TV series wey dem call, Barbee Rehab as Star Trek Ken.

Wactor also do voice work for di video game wey dem dey call Call of Duty: Vanguard wey comot for 2021.

Source