Popular Nigerian pastor Sam Adeyemi address why e dey fear to go Nigeria

One ogbonge Nigerian pastor wey be di oga kpatakpata of Daystar Christian Center, Sam Adeyemi don tok tori about im japa to di United States of America.

Oga Sam Adeyemi bin show face for one interview Mic On Podcast, wia tok say im and im family don dey America since COVID-19 pandemic shele for 2020.

Di pastor church dey popular for Nigeria sake of how im dey preach and im motivation work.

57-year-old pastor Adeyemi for di interview tok say im bin first plan to return to Nigeria but change mind afta gbege bin burst sake of di EndSars protests against police wahala.

Around dat time, one rights activist, Kenechukwu Okeke, bin file criminal complaint against Oga Adeyemi and 50 odas including some celebrities sake of dem allegedly promote di EndSars protest.

Di celebrities bin den file suit wey ask make court throwey di charges against dem.

For January 2021, one High Court for Abuja bin order stop to di prosecution of Pastor Sam Adeyemi and odas wey join dey di suit.

Oga Adeyemi say im relocation to America no get anytin to do wit Endsars. E say im and im wife bin don already shift dia work to global work since 10 years ago and dem don already open offices for Atlanta so dem go fit use technology and di systems wey dey obodo onyinbo to reach pipo.

‘Bad dreams’

Pastor Sam Adeyemi further tok about how im and im wife bin make plenti attempts to return to Nigeria but no fit sake of one ‘bad dream’ and dangers wey fit shele anytime dem fix date to return.

“Wen COVID-19 bin start, all our children bin dey di US, so evri one stay wit dia families. We bin stay wit our children.

Di week services resume na wen EndSARS bin start, so we bin dey prepare to return to Nigeria. Wen di EndSARS protests end for violence, we bin stay back small,” Pastor Adeyemi tok.

Oga Sam give detail about di dream wey im and im wife bin dey get all di time.

“Wen we ready to return to Nigeria, one different experience altogeda bin happun. My wife bin dream wia she bin travel to Nigeria and return to di US, wey be bad dream. I bin tell her say I no like dis dream. Three days later, I dream my own too.

Sam Adeyemi further explain say inside di dream “We both bin travel to Nigeria for my dream, and I bin dey one big fight. I dey attacked violently and bin ask di Holy Spirit for my heart wetin to do”.

“E bin say make I call di name of Jesus Christ. I bin shout ‘in di name of Jesus Christ’ inside di dream and no realise say I bin shout out loud for real life, e add.

“My wife bin wake me up for 2:00am dey hit me and ask wetin dey go on. Di two of us den decide to take am serious, especially say na di dream we get three days earlier. We bin pray seriously, we sense danger.

“Three hours later, I fall back asleep and get anoda dream. We bin dey Nigeria dis time, and I dey inside fight.

E explain say anytime dem arrange dia travel back to Nigeria, dat bad dream go shelle again.

“Few days later, we bin call family members for Nigeria, and one pesin say im feel very uncomfortable about you to travel to Nigeria.’ We bin call anoda family member wey tok say, ‘I feel uncomfortable about you coming. Wetin dey go on?’

“We just turn and look each oda, dey reason di situation. Den I say, ‘You sabi wetin? I don be Christian for 40 years. At dis point, if God dey speak to me, I suppose get idea say na God dey speak. Sometin dey go on. I no know wetin e be, but I wan pray more.

“And at dis point, we bin call meeting of all di leaders for Daystar Christian Center, di top 120 leaders on Zoom. Dem tok say you neva deceive us bifor. If God ask you to stay, stay as long as e direct. We go kontinu dis journey.

Pastor Sam Adeyemi church get ova 40,000 members.

Di ogbonge pastor say if God inspire am to enta politics im fit consider am for future as im dey worry about Nigeria young pipo future.

Source