Video show how worker dey piss inside tank wey contain ingredients dem dey use make beer

Tsingtao

Getty Images
Tsingtao na China second-biggest beer maker and dia biggest beer exporter

Chinese authorities dey investigate afta one viral video show one worker from Tsingtao as e dey urinate inside one tank wey contain ingredients for dia popular beer.

Di clip don receive tens of millions of views on social media.

Di company tok say dem alert police immediately afta di video come to dia attention, and dem add say di batch of ingredients don dey sealed.

Tsingtao na one of China top beer producers and dia biggest exporter.

For di video wey appear online on Thursday, one worker wey wear uniform wit helmet climb ontop high wall and into di container before im begin urinate inside am.

Di location tag of di clip read “Tsingtao beer No.3 factory”, local tori pipo The Paper report on Friday.

Business tori pipo “National Business Daily” later tok say one internal source tok say both di pesin wey take di video and di pesin wey dey inside no be direct employees of di company.

Inside one statement wey dem publish on Friday, di bureau of market supervision and administration of Pingdu City, where di factory dey, tok say dem immediately set up one team and conduct on-site investigation afta dem spot di video, and seal di whole batch of ingredients wey appear inside di clip.

Dem also add say di bureau go deal wit di mata seriously once details don dey confirmed.

Screengrab of di viral video show di worker climb enta di container

Getty Images
Screengrab of di viral video show di worker climb enta di container

Tsingtao tok on Friday say dem “attach great importance” to di online video, and di police don start investigation.

Di BBC don reach out to di company for comments.

Di clip shock Chinese social media as di brand na brand wey dey very popular for home and abroad.

“Piss wey go ruin a lot of money, dis worker don do some real damage here,” dis na wetin one pesin write for social media platform Weibo, wey be like X.

“Good tin say I no dey drink beer – but e dey unimaginable if dis brand own don finish sake of dis,” one user tok.

“Shey dis na di first time sha?” anoda pesin tok.

Shares for Tsingtao Brewery fall shapaly wen di Shanghai Stock Exchange open on Monday morning but dem bin dey trade broadly flat for afternoon.

Di Hong Kong market, wia Tsingtao shares also dey listed, bin dey closed on Monday for di Chung Yeung Festival holiday.

Source