Some athletes of Nigerian descent wey win medals for oda kontris for Paris 2024 Olympics

Ogunleye, Echikunwoke and Naser dey celebrate dia victory as dey show of di flags of kontris wey dem represent

BBC

Paris 2024 Olympic don come and go, and Nigerians no gbadun di outcome at all.

Di most populated kontri for Africa bin follow participate for dis year Olympics wia dem bin send 88 sports men and women to represent di kontri.

But in di end, di kontri bin no win even one single medal. Dis one make am di number eight times wey Nigeria go waka go Olympics, carry empty hand return.

Dis disappointing result don provoke plenty pipo for di kontri sotey, di minister od sports, John Owan Enoh don do public apology give im kontri men.

In fact, di one wey come pain Nigerians add to di failure of di athletes wey represent dem, na say, Some Nigerians wey bin represent oda kontris perform well as dem carry medal for those kontris.

Meet some of di Nigerians wey make oda kontris wia dem also get allegiance proud.

Yemisi Ogunleye (Germany)

Yemisi Ogunleye afta she win gold medal for Germany for di 2024 Paris Olympics

Getty Images

Yemisi Ogunleye get Nigerian papa wey from Ekiti state and mama from Germany.

Ogunleye make history by winning di gold medal for women shot put for Germany during di Paris 2024 Olympic.

Her victory mark Germany first gold medal for di event inside 28 years, since Astrid Kumbernuss first win am for 1996.

Ogunleye first be ballet dancer and gymnast before she switch to athletics wen she bin dey 13 years.

Afta plenty injuries wen she be teenager, her career bin hang. But she battle her way back.

Yemisi also love to sing. She sing wit her sweet voice for Yoruba language afta she win di gold for di competition.

Salwa Eid Naser (Bahrain)

Salwa Eid Naser break record for di 2019 IAAF World Championship to become di youngest champion for 400m event

Getty Images
Salwa Eid Naser break record for di 2019 IAAF World Championship to become di youngest champion for 400m event

Salwa Eid Naser bin claim di silver medal for di women 400 metres for Bahrain.

She be di world champion for di 2019 IAAF World Championship, wia she bin make di third fastest time in history, to become di world youngest champion for di event.

Dem born Salwa Eid Naser as Ebelechukwu Agbapuonwu, to Nigerian mother and Bahrain papa, for Onitsha Anambra state, south east Nigeria.

Nasear wey specialise for 400 metres, bin begin athletics wey she bin small for Nigeria, and even perform for 2013 School Sports for Port Harcourt, Rivers State and also for National Youth Games for Illorin.

Naser later leave Nigeria, switch commitment to Bahrain for 2014, wia she continue to dominate for track and field.

Di Olympic 2024 Silver medal na addition to her collection of international medals.

Annette Echikunwoke (United States)

Annette Echikunwoke bin suppose represent Nigeria for 2020 Tokyo Olympics

Getty Images
Annette Echikunwoke bin suppose represent Nigeria for 2020 Tokyo Olympics

Annette Echikunwoke, wey dem born for Ohio get Nigerian parents.

She win silver medal for United States for di 2024 Olympic Games for di Women Hammer Throw.

She set Nigeria record four times and make am to di Olympic team.

Annette bin suppose represent Nigeria for di 2020 Tokyo Summer Olympics, but dem disqualify her sake of Athletic Federation of Nigeria fall her hand.

As she land Tokyo for 2021, officials call her plus one oda Nigerians enta conference room, to tell dem say Nigeria Olympic Committee no do proper drug test and whereabout checks. Echikunwoke cry.

Her performance for Paris 2024 Olympics don add to her growing rep for di events.

Source