Why Peter and Paul of ‘P-Square’ dey kwanta again?

Fans of ogbonge award winning musical artistes, Paul and Peter Okoye wey pipo sabi as P-square dey react to tori say tins don fall apart again between di duo.

Recent revelations from di two ogbonge musicians wey be twins show say all no dey well between di two of dem.

One recent post from Peter Okoye wey dey known as Mr P, wia e take respond to one interview wey im twin brother Paul Okoye AKA Rude Boy do, don make pipo, especially dia fans dey wonder wetin dey occur between dis two brothers wey just get back togeda for 2021 as a singing team, afta dem break up for 2017 to go start solo career.

Mr P for one open letter wey e post on im social media accounts and address to im brother, accuse am say e dey always discredit im contributions and efforts to di group (P-Square) wey both of dem gada create and build togeda to di level of stardom.

E say for recent interviews wey Paul grant, e dey always claim say na im write and sing 99% of all P-Square songs and one song wey im do wit anoda artiste, e discredit am say na failure.

Although, Paul neva react to im response but dis na di interview wey e grant wey cause di recent outburst.

Wetin Paul Okoye tok for di interview?

Paul Okoye, for one recent interview e make for one radio station for Lagos City FM say right now, di duo P-square no dey again.

Dis na as many pipo especially dia fans dey expect make di duo drop albums afta di two of dem get back togeda.

Oga Paul for di interview bin open up on many tins about di musical career of P-Square, wey e tok say dey shake sake of creative differences and personal issues between di two of dem, wey e blame on influence of outsiders and bad friends.

Paul clear am say one of di tins wey dey cause rift between di two brothers na songs. E say dem accuse am say, e claim say, na only am dey do all di music dem dey sing for dia albums.

E say dat na why wen dem come back togeda, one of di tins wey im address be dat, say make di two of dem gada dey do di songs. “Wen we come back togeda, I tell am bring yourself in, show yourself, tell me wetin I dey do wey you no like, den e start to sing, becos I no want make we lose di P-square touch, I tell am if we wan do 10 songs, bring 5, make I bring 5, but e no work.”

“Out of four brothers wey dey work togeda, everybody dey play dia part, dis no be just about money.

“At some point, e be like say na only me dey do all di music, so I get to shift, so dat im (Peter) go fit do music too. I chop accuse say I claim say na me be di singer, while e be di dancer. Anytime we comot, pipo go dey question who be di singer and who be di dancer, I no no say those toks dey pain am and e dey take am to heart. I bin tell am one time say make e no dey allow those toks get to am, becos dat na di part dem see am dey play.”

‘No more P-square!’

Paul also reveal for di interview say di group don break again and e claim say na Peter tok say im wan quit.

Although, e no clearly tok wetin cause dis split as e tok say di new P-square bin dey peaceful before Peter drop di bombshell say make dem split. E say na all of a sudden di mata come up and wen im ask if make dem make am public, e say no.

“Di new P-Square bin dey peaceful. I no want make di past mistakes to repeat themselves. But den again, he [Peter] say im no dey interested again. In fact, e tell me to my face say im wan quit. I ask am if e wan make we make am public, e refuse. But wetin go happun wen I go solo? Pipo go call me di bad person. Dat na why I dey speak up now,” Paul tok.

E say im no dey say anytin to condemn anybody and nothing dey go on but im just get to make am clear to dia fans say nothing dey go on and nobody dey gang up against anybody.

“Di plan of our coming back together na to produce plenty hit albums. But as e be now, I dey focus on Rudeboy.”

Paul for di interview also mention one case e get wit Nigeria corruption police, Economic Financial Crimes Commission (EFCC) for December 2023, wey e allege say na im twin brother set am up wit dem.

E say im land EFCC custody afta one petition wey im twin brother petition di EFCC to arrest am on multiple charges, wey include im lifestyle.

E claim say even though di EFCC clear am of all allegations afta thorough investigation, im twin brother no gree to apologise for di false claims.

“Dis year, EFCC bin invite me afta dem receive one petition against me from my twin brother. I no ever tink say [our beef] go go dis far. I tink say na just music,” e tok.

Points Peter make for im open letter to Paul

For one long open letter e write to im brother, Paul Okoye, e reveal some of di incidents wey lead to di katakata for Psquare.

Peter say im don see di countless interviews wey Paul dey constantly discredit im effort for di group.

“In your recent interviews, you claim say na you write and sing 99% of all P-SQUARE songs and you discredit me as you tok say our song wit TI, “EjeaJo,” wey I write na failure. You even use YouTube views to discredit me again.

You no ever acknowledge di oda songs like “Get-Squared,” “Bizzy Body,” “Personally,” “Roll It,” “Temptation,” “Alingo,” “More than a Friend,” “Shekini,” “Say Your Love,” “Gimme Dat,” “Senorita,” “IGBEdu,” and a few odas. Dis songs also dey considered failures? Paul ask.

“Every time I don tok for interviews about P-SQUARE, I dey always use “we” and “us” becos I see us as a team. But whenever you speak, na always “I” and “me,” even wen I dey stand right beside you. E dey as if I never exist.”

E tell im brother say one thing e get to understand say fans no love P-square because of who dey sing abi who dey dance di most, wetin make dem special na di magic wey come from dia combined effort.

“P-SQUARE na force, and di fans fall in love with P-square becos of our uniqueness and unity, both of us get talent, no doubt and I don ofen praise you for for our interviews for your songwriting ability. But instead make you show gratitude for my kind words, e be like say you find satisfaction in rubbing am ti my face, you forget say na by God grace, we come dis far.”

‘I no ever report my twin brother Paul to EFCC’

Peter also clear am say im no ever petition EFCC against im twin brother but against im elder brother Jude Okoye and im wife.

E say im challenge Paul or anyone else to show any petition wey im Peter Okoye ever submit against im twin brother Paul or wey carry Paul name on am.

Who be P-square?

Di dancing and singing pop group P-square bin appear for di Nigeria music scene for 2003.

Dem become popular as pipo begin dey hype dia dance style wey wan resemble Michael Jackson and Usher own.

For dia career, dem bin drop seven albums and different single releases with international collabo with Akon, Jermaine Jackson and Rick Ross.

Some of dia biggest hits na Busy Body, Do Me, Ifunaya and Break It.

Dem win many national and international awards wey include di 2006 Headies for Artiste of di year, Song of the year, Best R&B/Pop Album, and Best music video; Best Group awards for di MTV Africa Music Awards for 2008 and 2009.

Many pipo go always remember di Africa finest artistes Psquare wit dis song, “Peter and Paul be one no be two.”

P-square bin come back togeda for 2021 afta one fall out dem bin get for 2017.

Source