How Ondo state, Nigeria dey pay dia last respect to late Govnor Rotimi Akeredolu

Di bodi of late Ondo state Govnor Rotimi Akeredolu don touch down Akure, di Ondo state capital on Wednesday as part of di burial ceremonies dem don schedule for am.

Na 23 February, 2024 dem go bury di former govnor, Rotimi Akeredolu SAN.

Akeredolu bin die afta im battle wit cancer for Germany and dem bring im remains come back Nigeria on 5 January, 2024.

Di ceremonies to take am to im last resting place bin start on Thursday, 15 February.

Di final commendation service take place for Ibadan, Oyo state capital as dignitaries pay dia last respect on Tuesday.

For di All Saints Church Jericho Ibadan, crowd full as dem pray for di bodi of di late govnor.

Some pipo wey attend di service include Akeredolu wife, Betty Anyanwu Akeredolu, Justice Bolaji Olajuwon, Oluwarotimi Odunayo Akeredolu Jnr Babajide Akeredolu, Lady Ifeoma Atuegwu, Dr Teniola Akeredolu-Micheals and Pastor Kola Akeredolu.

Odas wey come include di deputy govnor of Ondo state, Dr. Olayide Adelami, former govnor of Ekiti state, Kayode Fayemi, former deputy govnor of Osun state, Sen. Iyiola Omisore, speaker House of Assembly Ondo state, Olamide Oladiji, APC Chairman, Ondo state, Ade Adetimehin and top goment functionaries.

Di atmosphere dey very sober wen di bodi of late Akeredolu bin enta di church.

Timeline: How Akeredolu burial go happun

Thursday 15 February, 2024:

Winning Soul Crusade for MKO Abiola Democracy Park, Akure

Friday 16 February:

Jumat Service for Akure Central Mosque

Saturday, 17 February

Loyola Day of Tributes for Loyola College Hall,

Sunday, 18 February:

OAU Night of Tributes

Monday, 19 February:

Special Court Session

Tuesday, 20 February:

Commendation Service

Private Viewing (Strictly By Invitation)

Wednesday, 21 February:

Ajabue (Traditional Rites)

Special Court Session

Lying in State and Commendation Service

Evening of Tributes

Thursday, 22 February:

Service of Songs

Wake-Keep

Candlelight Procession & World Gyration

Friday, 23 February:

Funeral Service

Interment go follow immediately afta di burial service for di burial site, Owo. (Strictly for immediate family)

Saturday, 24 February:

Akeredolu Memorial Friendly football match

Sunday, 25 February:

Thanksgiving Service

Fotos from di commendation service

Pipo for di service

BBC
Dis service na part of di burial plans for late Akeredolu
Casket wey carry Akeredolu

BBC
Akeredolu bin spend months on medical leave before e return come Nigeria

Ondo declare public holiday

Ondo State govnor Lucky Aiyedatiwa, bin delcare February, Thursday 22 and Friday 23, as public holidays for di state.

Aiyedatiwa say na to honour dia late govnor.

Source