Nigeria goment suspend Dana Air flight operations with immediate effect afta accident

Nigeria goment don order di suspension of Dana Air, one local airline for Nigeria.

Di suspension dey come sake of di accident wey happun on Tuesday, afta di aircraft wey carry 83 passengers wey bin dey fly from Abuja to Lagos comot from runway.

Na for di Murtala Mohammed Airport for Lagos, Nigeria commercial capital e happun and no body die or wound.

Dr Emmanuel Meribole wey be di Permanent Secretary for di Ministry of Aviation and Aerospace Development for statement direct di Director General of di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) to suspend di fleet of Dana airline immediately.

“As di supervisor wey dey over see di safety regulations and compliance for di kontri, e don come to di minister attention about di recent incidents wey involve Dana Air wey don raise serious concerns about safety and financial viability of dia operations.

Wit di important priority wey be safety and well-being of citizens and travellers, di minister don direct make dem immediately suspend Dana fleet until dem do comprehensive audit.” Di statement tok.

According to di statement, di audit go cover all safety protocols, maintenance procedures and financial health to ensure full compliance wit aviation guidelines.

“Di recent incident wey happun make dis mata dey urgent, and e also dey important to take decisive measures sharp sharp to safeguard di interests of stakeholders.”

How Dana aircraft comot from runway for Lagos

Passengers for di Dana Air aircraft wit registration number 5N BKI wey bin dey fly from Abuja to Lagos on Tuesday escape tragedy.

Tori be say di aircraft bin get accident as e run comot from di runway of di Murtala Mohammed airport for Lagos.

Di runway accident happun wen di aircraft comot from di runway wey dem dey use during take-off or wen e wan land. Dem dey call am ‘runway excursion’

Dana Air bin confam di statement and assure say di passengers come out from di aircraft safely witout any wound.

Dem also tok say dem don report di incident to di Nigerian Safety Investigation Board (NSIB) and di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA).

Dem also tok say dem don ground di aircraft so dat di maintenance team to look am to know wetin happun and any oda investigation.

Di Nigeria Civil Aviation Authority for statement wey Capt. Chris Najomo sign bin also give more tori about di incident wey happun and di aircraft.

“Di Nigeria Civil Aviation Authority dey tell di public say on 23rd April, 2024 at about 08:25, one Dana Airline aircraft bin dey involved for runway excursion occurrence.

“Di Aircraft, wey be MD82 wit registration marks 5SN-BKI, comot from Abuja dey go Lagos wit 83 passengers and 6 crew members onboard.

Wen dem wan land for di Murtala Mohammed International Airport, di Air Transport Controller [ATC] Tower observe from C4 say di Nosewheel don retract, and di nose of di aircraft don collapse as di aircraft run comot from di runway go enta wia grass dey.”

In line wit statutory procedures, di Nigerian Safety Investigation Bureau don start to investigate di incident wey happun.

Dis no be di first time Dana Air dey get aviation issues wey concern aircraft.

For 2018, di emergency door of di aircraft bin fall comot as di plane dey land.

One of di passengers bin tell BBC Pidgin say ‘Fear catch us well-well’

For 2012, di airline involve for one ogbonge air crash wey kill pipo.

Di Accident Investigation Bureau, AIB, later say na mechanical failure and pilot error cause di 2012 air crash in Nigeria wey kill 159 pipo.

Di AIB, for im final report, say two engines for di Dana Air flight fail mid-air before e crash as e dey approach di Lagos airport.

Source