Fotos: Women gada for Owo to lay ‘curse’ on pipo behind church attack

Women agda to curse pipo behind Owo attack

BBC

Some group of women gada for Owo town for Ondo state south west Nigeria to perform wetin dem call traditional rites to place curse on those behind attack on church wey claim plenty lives.

Na on Sunday, 5 June, 2022 some gunmen attack St Francis catholic church during service, kill at least 20 pipo and about 50 pipo injure.

Dis group of women say dem dey invoke di traditional spirits to fight on dia behalf and bring di perpetrators to justice.

“Our ancestors go ansa our prayers and those pipo go regret ever coming to Owo”, one of di women tok.

Dem gada cutlass, leaves and some herbal concoctions to pray for justice against di pipo wey dey behind di attack.

Fotos from di women protest

Women gada to curse pipo behind Owo attack

BBC
Women gada to curse pipo behind Owo attack

BBC
Women gada to curse pipo behind Owo attack

BBC
Women agda to curse pipo behind Owo attack

BBC
Women dey protest

BBC

Di attack bin happun for one Catholic Church for inside Owo, Ondo state on Sunday.

According to di leader of St Francis Church, Father Andrew Abayomi, di attackers enta di church wen dem dey close service , throw dynamite and begin shoot at pipo.

E neva dey clear wetin be di motive behind di attack but authorities don launch investigation .

Di state police commissioner say e don also order immediate deployment of armed and specialised policemen to di area to restore normalcy and fortify di entire community.