How Netherlands beat Senegal for dia first game for Qatar

2022 World Cup

Getty Images
Netherlands thrash Senegal 2-0 for Qatar

Netherlands thrash Senegal 2-0 to win for di Group A game for di ongoing Fifa World Cup for Qatar.

Cody Gakpo na im score di first goal 84 mins into di game and Davy Klaassen score di second goal for di 98th minutes.

Di Senegal keeper fumble for di 99th minute attempt by Memphis Depay.

Senegal Sadio Mane dey miss di World Cup sake of knee injury. Also, Netherlands forward Memphis Depay no dey for di match sake of hamstring issue.

Di Netherlands don wait for ages for dis day afta dem fail to qualify four years ago. Dis na dia first game for di World Cup since dem defeat hosts Brazil for di third place play-off on 12 July 2014 – 3,054 days ago.

Di Netherlands na di only team wey don play for at least three World Cup finals and still neva di trophy.

Di game take place for di Al Thumama Stadium for Doha.

Na 40,000-capacity arena and na di only completely circular venue for dis World Cup.

Di game as e happun

2022 FIFA World Cup

Getty Images
Netherlands thrash Senegal 2-0 for Qatar

FULL-TIME

Senegal 0-2 Netherlands

90+8 mins: Dat na shocker by Edouard Mendy.

Di Senegal keeper fumble for di 99th minute attempt by Memphis Depay and Davy Klaassen dey for di right place to sweep home im side second.

A night to forget for Mendy and Senegal.

90+8 mins: GOAL !

Senegal 0-2 Netherlands

90+7 mins: Senegal dey frustrated. Idrissa Gueye and Nampalys Mendy collect yellow cards in quick succession.

90+5 mins: Cody Gakpo get standing ovation from di Dutch supporters inside di ground. Dem replace am wit Marten de Roon for di closing moments.

90+3 mins: Senegal don attempt 360 passes for dis game, dia highest total for one single match for di World Cup since di start of last season.

Na shame say dem no test di Dutch keeper enough.

90 + 2 mins: Aliou Cisse neva give up. Di Senegal coach dey on di sidelines as e dey shout instructions give im players. Enough time dey for dem to carve out at least one more good chance.

90 mins: Dem add EIGHT minutes!

89 mins: Senegal don really miss Sadio Mane. Di African champions lack di cutting edge up front.

88 mins: Cody Gakpo now don dey involved for four goals for im last four international appearances for di Netherlands (3 goals, 1 assist).

87 mins: Strong response by Senegal as Pape Gueye shoot from di edge of di box but Andries Noppert save am.

84 mins: GOAL!

Senegal 0-1 Netherlands

Cody Gakpo score di goal for Netherlands.

Dis game bin get 0-0 written all over am before a lovely delivery by Frenkie de Jong find Cody Gakpo wey get up to nod am pass Edouard Mendy.

Senegal dey stunned.

81 mins: SUBSTITUTIONS

Davy Klaassen and Teun Koopmeiners dey on for di Netherlands.

Dem go fit provide di much-needed spark? Dis game dey move towards to be di dullest of goalless draws.

80 mins: Ten minutes left. Who go win?

Hit thumbs up for Senegal. Down for di  Netherlands.

77 mins: Dem don announce di official attendance as 41,721. E dey interesting because e use 1,700 pass di normal capacity!

Di ground look only about three-quarters full.

75 mins: SUBSTITUTION

Small changes dey for Senegal in di past few moments.

Nicolas Jackson, Bamba Dieng and Pape Gueye dey on.

73 mins: Senegal dey temporarily down to 10 as di game dey go on. Di African champions don carve out great chance but Andries Noppert no dey help all Idrissa Gueye attempt.

E for count. Di offside flag dey up.

71 mins: Bad news for Senegal. Dem load Cheikhou Kouyate inside stretcher before dem carry am go. Di Nottingham Forest player bin jump up for one challenge before e land.

70 mins: E be like say Kouyate dey in position to carry on.

69 mins: Match don stop. Cheikhou Kouyate dey down and no dey move.

66 mins: SUBSTITUTION

Senegal don also make one change. Ismail Jakobs dey on for Abdou Diallo, wey dey look like say e just collect knock.

65 mins: One ogbonge save by Andries Noppert wey just make im first international appearance.

E quick to stop Boulaye Dia.

63 mins: SUBSTITUTION

Dis game dey cry for goal. Memphis Depay go fit provide am? E no suppose play for dis game sake of hamstring injury but e just dey play to support Vincent Janssen. Dis fit dey significant for di Netherlands.

61 mins: Strong punch by Edouard Mendy before Denzel Dumfries fit cause any damage.

56 mins: YELLOW CARD!

Yeye challenge by Matthijs de Ligt on Ismaïla Sarr result for di first yellow card of di game.

53 mins: CLOSE!

Big, big chance for di Dutch.

Anoda corner and dis time na good delivery and Virgil van Dijk rise but e no fit keep im header down.

51 mins: Edouard Mendy no get much work to do but e do well to catch one corner afta e jump several orange shirts.

49 mins: E be like say both teams dey fear to take risk.

48 mins: Slow start to di half. Three points dey on offer and di chance to join Ecuador for di top of Group A. Both teams dey play at a slow tempo.

47 mins: Senegal Ismaïla Sarr don dey involved in more shot creating actions dan any oda player for di first half (4 – 2 shots, 2 chances created).

45 mins: Di African champions return back to di game.

SECOND HALF

HALF TIME

Fun game but e need a goal.

45 mins: One wayward header by Youssouf Sabaly give di Netherlands corner but na anoda poor delivery.

42 mins: Free-kicks for dis game dey terrible. Both teams really need to improve dia set-pieces.

40 mins: Steven Berghuis lash ova from outside di penalty area. Dis one sum up di Dutch so far. Plenty of effort but dem no fit test di keeper.

36 mins: Emma dey on di spot. Mendy neva score any goal and we dey di final 10 minutes of di first half.

34 mins: Make we no beat around di bush. One team suppose don score for dis game.

32 mins: Anoda free-kick for di Netherlands just outside di box. Dis na anoda good chance but once again Senegal easily stop am.

Cody Gakpo bin suppose do beta wit dat delivery.

29 mins: Senegal dey enjoy possession of di ball.

One disaster almost happun for Frenkie de Jong wey im casual clearance inside im own box end for one attempt for Idrissa Gueye.

Netherlands dey lucky to escape dia

26 mins: Great defending by Virgil van Dijk!

Dem allow Ismaïla Sarr time to line up one shot outside di box and im powerful attempt go over di bar.

E bin look like say di ball go enta net.

24 mins: Plenty noise dey come from both sides but e no mean anytin. 

22 min: Di Dutch don get Free-kick just outside di box afta dem foul Matthijs de Ligt. Dem send six Oranje shirts go di penalty area waiting for di set-piece but na disappointing attempt.

20 mins: Frenkie de Jong miss one ogbonge pass Steven Bergwijn give am. But e take one touch too many and Senegal dey able to clear am. Dem waste big opportunity.

17 mins: One lovely pass by Cody Gakpo see Denzel Dumfries inside di box but Senegal dey try too.

Gakpo dey cause problems. E send in one cross wey dey cause all kind of problems.

13 mins: Senegal dey take frequent breaks and di Dutch need to dey tight for di back. Dem bring anoda attack by di Africans to an end by one offside flag.

11 mins: Dem stop di game to allow Pape Abou Cisse receive treatment.

9 mins: Anoda attempt by Senegal.

Dis time Ismaila Sarr dey on di edge of di box wen e create space for imself before firing over.

6 mins: Big chance for di Netherlands!

Nampalys Mendy switch off and di ball pass di Senegal penalty area but no one for di Oranje fit connect.

Dat na big let off for Senegal.

2 mins: Di Oranje start di game but dem give di ball away early.

Di champions of Africa dey on di attack and early chance dey for Cheikhou Kouyate but e dey deflected away.

Di No 3 game for di 2022 World Cup don start!

I min: Senegal 0-0 Netherlands

FIRST – HALF

2022 World Cup

Getty Images
Senegal vs Netherlands

Senegal line-up

Senegal fans

Getty Images

16 Mendy

21 Sabaly

3 Koulibaly

4 Cisse

22 Diallo

Kouyate

6 Mendy

5 Gueye

18 Sarr

9 Dia

15 Diatta

Substitutes

1 Dieng

2 Mendy

7 Jackson

10 N’Diaye

11 Ciss

12 Ballo-Toure

13 Ndiaye

14 Jakobs

17 Sarr

19 Diedhiou

20 Dieng

23 Gomis

24 Name

25 Loum

26 Gueye

Netherlands line-up

2022 World Cup

Getty Images
Netherlands vs Senegal

23 Noppert

22 Dumfries

3 de Ligt

4 van Dijk

5 Ake

17 Blind

21 de Jong

8 Gakpo

11 Berghuis

18 Janssen

7 Bergwijn

Substitutes

1 Pasveer

2 Timber

6 de Vrij

9 de Jong

10 Depay

12 Lang

13 Bijlow

14 Klaassen

15 de Roon

16 Malacia

19 Weghorst

20 Koopmeiners

24 Taylor

25 Simons

26 Frimpong

Referee: Wilton Pereira Sampaio