‘Mortuaries don full, pipo dey keep deadibodi for house’ – Kontri battle heatwaves

Mortuary

Getty Images

More dan 100 pipo don die for Mali sake of veri hot heatwave wey bin hit di kontri last month, tori pipo dey report.

Last week for di south west town of Kayes dem record temperature wey high reach 48.5°C.

Di na di hottest day wey Africa don eva record for im history for di month of April, according to meteorologists wey one online news website RFI, bin quote.

Gabriel-Toure Hospital for di kontri capital, Bamako, receive 102 patients wey heat bin affect, wey die as dem reach di hospital, French RFI news website report.

Most of dem bin dey ova 60 years old and dem bin dey seriously sick, Djibo Mahamane Django, head of anaesthesia department for di hospital tell local tori pipo Joliba FM.

Some local sources say pipo wey don die inside three day pass 250.

“We dey see increase in di number of deaths, and di mortuaries full pass bifor,” Ladji Dibatéré, one funeral home owner, tok.

Dibatéré say families dey forced to keep di deadibodi of dia relatives for house.

Officials don tell area pipo make dem stay for place wia breeze dey enta well well plus dem also restrict learning for schoolchildren as young and elderly pipo na dem di tin dey catch pass, Mali state TV ORTM station report.

Authorities don also reduce, plus change school hours for primary school students to protect dem from di harsh temperatures.

Di high temperature dem say dey occur sake of di El Nino weather phenomenon, wey raise di temperature of ocean and di atmosphere.

Mali military leader neva comment on di temperature wey dey rise.

black man dey drink plus pour water for im heat to cool im temperature

Getty Images

How pesin fit cope with dis kain heat weather?

Small pikin and elderly pipo na im dey most vulnerable and most affected by dis heat wave weather even though evri bodi dey suffer am for different degrees.

To come wit di weather, head of Geography department, Rivers State University, Prof Precious Ede, advise pipo to do di following:

1. Ventilate di environment. Open windows so air from outside fit cross di room.

2. Drink more water. As di heat dey make pesin sweet well well, e mean say di bodi need more water to replace di one wey dey comot as sweat so e dey advisable for pipo to drink more water dan wetin dem dey used to.

3. No do too much exercise or anytin wey go make you sweat too much. E advise pipo to moderate all dis exercise so dem no go stress dia bodi system too much as dem already dey stressed by di environment.

4. Wear light- material clothing like cotton so e go allow air touch di bodi.

5. Make pipo wey get air conditioner use am cool dia bodi.

Source