Mohbad father tok wen im go bury im son

MohBad /father

BBC

Di father of di late Afrobeat star, Ilerioluwa Oladimeji Aloba wey pipo sabi as MohBad say im family dey wait for di DNA and autopsy result, before dem go bury di musician wey die last year.

Joseph Aloba tok dis one for interview wey im do wit tori pipo TVC for 10 January.

‘’You know say I don bury Mohbad before, dem bring out from grave again sake of some reasons’’. E tok.

‘’Di reason na to know exactly wetin kill am, we still dey expect di result, wey dey necessary before we go fit bury am’’. E add.

MohBad bin dey married and get one pikin before im die.

Many pipo bin mourn di musician for inside Nigeria and outside di kontri to demand for justice for di singer.

Dem mourn di 27-year-old singer sake of di circumstances wey surround im death.

Na afta all di protest authorities announce say dem go investigate di mata.

Few weeks afta, police name one nursing assistant wey inject di Afrobeats star wit drugs as di prime suspect for im death.

Dem also share details of MohBad last moment wey lead to im death for Lagos, Nigeria commercial center.

“MohBad, wey im real name Ilerioluwa Oladimeji Aloba, Injure imself for violent fight wit im childhood friend Oluwatosin Owoduni, aka Primeboy for 10 September, di Lagos State Police Command commissioner Idowu Owohunwa tok.

MohBad bin try to blow Owoduni. But e miss am and cut im hand before im go smash car window.

Na from di injury wey im get from di fight wit im childhood friend wey lead to im death.”

Di authorities also don begin one coroner case ontop im death,

‘I wan know di pesin wey dem give Liam placenta’

But many pipo still dey surprised why di family still dey keep Mohbad for mortuary almost five months afta im death.

Di musician father tok say di family need di DNA result of MohBad pikin.

According to di father ”Na becos I no know wen dem born Liam, MohBad son. I no know di pesin dem carry im placenta give.

My son call me, wen im call me I answer am, I bin wan go see am.. im tell me say Daddy no need again, I shock”.

”I remember wen im buy di land, di land bin dey hang wit im mother in-law, so dis same tin happun wit di placenta, e say Daddy no need again dem don arrange pesin wey go bury am. I bin keep quiet but I surprise wen di wife mention am”.

Di late singer papa say na im family suppose take care of di placenta according to Yoruba tradition, so e surprise am wen dem take am away from am.

”I wan know di pesin wey dem give di placenta, dat na why I need di DNA and autopsy result to come out before we do di burial”.

”If we no dey satisfied wit di result I no say di whole world go support me to take care of di body to find di real result…We go do private test for am”.

Since MohBad die last year, di father and im daughter in-law dey get issues ova di singer wealth, pikin and im cause of death.

Source