Junior Pope: How to do CPR, wetin to do if pesin drown?

Di death of Nollywood actor Junior Pope dis week don raise questions on wetin to do if pesin drown.

Junior Pope wey im real name na Obumneme Odonwodo and some crew members die afta dia boat capsize for River Niger Anambra state.

For Nigeria, river accident dey common, so if dis kain tin happun, you know wetin to do?

We go share some tips wit you, wey fit help save pesin wey drown for water.

Di first, and most important advice be say, no put yourself for danger! Use anytin you fit to bring di pesin wey dey drown out of water, but no put your own safety at risk – you no go fit help dem if you yourself dey in trouble.

If you manage comot dem for water, den you must act very fast to help dem get oxygen to dia brain and organs. Di biggest killer for cases of drowning na lack of oxygen for di body, and by di time you comot pesin from water, dat na di major tin to deal wit. Dat na why sabi pipo advice rescue breaths first dat one na to use your mouth blow air to di pesin wey drown mouth before you start to do chest compressions.

Di National Health Service (NHS) give first aide advise on wetin to do

If you dey on your own, shout for help but no waste time to move di pesin to lifesaving techniques. If someone else dey wit you, make phone call for help immediately as you dey do dis tins:-

Try to wake di pesin: Shake dia body well, or even pinch dia ear. If dem no show any signs of consciousness…

Lie dem for dia back and raise dia chin and head backwards: Dis go help clear dia airway. Dis fit help dem to start to breathe again.

Check if dem dey breathe by leaning ova dem and placing your cheek near dia mouth.

LOOK dia chest to see if dia chest dey rise and fall, FEEL for breath for your cheek and LISTEN for breathing sounds. If no sign of breath den you suppose give dem …

Give dem 5 rescue breaths: Pinch dia nose and tilt dia head back as you breath inside dia mouth from your own.

Each breath you dey give dem suppose last 1 second, and make sure you take deep breath yourself in between each one. These breaths go get valuable oxygen for dia lungs, wey particularly dey important for drowned casualty. Afta you don give 5 rescue breaths try…

CPR: You go use two hands togeda, one on top of di oda, push down right for di centre of dia chest firmly, wit your arms straight. Push down 5-6cm each time, twice a second Do am for 1 minute (120 compressions).

If you dey on your own, once you finish to do five rescue breaths and one minute of CPR you fit take time to call di emergency services. Hopefully you go don help di drown victim get some oxygen go dia brain. But as soon as don call for help, den continue:

30 chest compressions followed by 2 rescue breaths ova and ova again until dem start to breath normally or help arrives (if una dey two makr una take turns).

If di pesin wey drown don start to breathe normally again before help come, den roll dem into di ‘recovery position’, lie dem for dia side, wit dia top leg and arm bend dem up, and tilt dia head slightly back to help keep dia airway open. If you get any spare cloth to help keep dem warm, den use am cover dem , dey tok to dem to reassure dem say help dey come.

Most victims of drowning fit no suffer from cardiac arrest, wey fit dey helped by di use of one machine wey dem dey call defibrillator, although if you dey somewhere wia one dey available, den you fit try am. Dry di skin wey you dey put di defibrillator pads to as much as possible, but you no need to worry about problems or extra hazards from using di defibrillator for wet conditions. E dey more important, however, to help get oxygen around di body, so certainly give rescue breaths and CPR first.

Source