Kaisha na di latest housemate to comot from di Big Brother Naija show afta four weeks for di house.
She dey part of di four housemates wit di lowest votes from fans of di reality show dis week.
Her eviction dey come one week afta Eric and Tochi become di second set of housemates wey big brother ask to leave di house afta dem pull di lowest votes from fans and housemates.
Ka3na and Lilo na di first set of housemate to comot.
Di votes of di fans of di big brother Naija show na im dey determine di last four housemates wey go dey up for eviction every week.
Housemates wey bin dey up for possible eviction
- Victoria Adeyele AKA Vee
- Timmy Sinclair AKA Trikytee
- Praise Nelson
- Florence Wathoni Anyansi
- Kate Jones AKA Ka3na
- Ezekiel Bright Osemudiame AKA Brighto
- Aisha Umaru AKA Kaisha
- Emuobonuvie Akpofure AKA Neo
- Tolani Shobajo AKA Tolanibaj
- Olamilekan Agbeleshe AKA Laycon
- Rebecca Hampson AKA Nengi
- Lucy
- Dorathy
- Ozoemena
See how fans vote
Na Kaisha dey lead di bottom four votes with 3.48%, Trikytee follow wit 3.47%, Wathoni get 3.25% and Neo dey down di ladder wit 3.13%.
First week of eviction
Second week of eviction
Kaisha get 2.41% votes, Trikytee get 2.29% votes, Tochi na 2.11% votes, while Eric, wey dem bin nominate for eviction from di previous week, get di least votes wit 1.91%.
Out of 20 housemates wey start di race to win di 85million naira price, na 14 of dem remain to battle for votes from di public and housemates to get chance to be di last pesin standing.
How di Live Eviction dey work dis season?
At least one out of di 16 housemates wey dey up for possible eviction go leave di show on Sunday and di house get power to decide who dat pesin go be.
Each housemate go get dia time to nominate one of di bottom four housemates wey get di lowest votes from di public inside di Diary room.
Di Housemates wey get di highest votes from dia fellow housemates na im dem go evict from di house.
Dis na di first time di organizers dey introduce dis kain tin for di history of di reality television show.