China sound highest-level disaster afta heavy rainfall cause heavy oil spill

Waves crash on the coast of Sansha town in Ningde, for di Fujian province for China

Reuters

Typhoon Gaemi don hit China south-eastern coast, state media tok, afta e cause gbege for Taiwan and di Philippines

Dem don already move more dan 150,000 pipo for China southern Fujian province to safety, but authorities dey worry about di effects of more intense weather on di region wey already don see record levels of rain dis year.

Taiwan coastguard also dey search for nine Burmese sailors wey bin dey on board one cargo ship wey sink for di rough seas.

Three pipo don die and hundreds more wunjure wen di storm bin pass over Taiwan earlier.

Meanwhile authorities for di Philippines say at least 21 pipo don die sake of flooding and landslides.

For Taiwan, di storm force officials to cancel parts of di island largest annual military drills, along wit almost all domestic flights and more dan 200 international flights.

Di island Central Weather Administration also sama land warning for all of Taiwan.

One of di three pipo wey die for Taiwan na motorist wey dey hit by tree wey, authorities tok.

Anoda dey crushed by excavator wen e bin overturn.

Authorities now don relocate more dan 8,000 pipo across di island for some time.

Gaemi make landfall for Taiwan around midnight on Wednesday (16:00 GMT), on di northeastern coast close to Yilan county.

Dat Wednesday, goment declare typhoon day, suspend work and classes across di island except for di Kinmen islands.

On Thursday, schools and offices still dey closed, while flights to and from Taiwan don also dey cancelled.

For di capital Taipei, shelves for supermarkets dey bare as pipo stock up ahead of expected price increases afta di typhoon don pass.

Di typhoon bin first dey expected to hit further north, but di mountains of northern Taiwan bin turn am slightly south towards di city of Hualien.

Di typhoon dey expected to weaken as im tracks over di mountainous terrain of Taiwan bifor e show again for di Strait towards China.

One second landfall dey expected for di Fujian province for southeastern China later on Thursday.

Some rail operators for China don also suspend operations.

Six tins to know about di incident

‘Race against time’ to contain oil spill from tanker wey capsize

Terra Nova drifts off Manila Bay

EPA

Video wey Philippine Coast Guard release show part of di fuel tanker Terra Nova head still dey show from di sea.

Di coast guard bin detect one oil slick wey stretch about 2.5 miles (4km) and describe am say e “big”.

One tok-tok pesin, Rear Admiral Armando Balilo, tok say di agency dey “race against time” to contain di spill and say danger say di surrounding marine environment go dey affected – as well as di capital Manila and im shoreline.

Manila Bay, wia di tanker bin sink, host busy shipping lanes and im shores na home to shopping malls, casino resorts and fishing communities.

Experts say for one ordinary clean-up, officials go immediately deploy booms, or temporary floating barriers, to limit how far di spill fit spread.

But di rough weather and high waves today don delay dis efforts. Di incident come one day afta Typhoon Gaemi increase seasonal monsoon rains, submerge wathes of Metro Manila and im suburbs for deep floods.

‘I no get nothing now’

Pipo for di Philippine capital Manila don tell tori pipo AFP news about wetin dem don lost for di typhoon.

Street vendor Zenaida Cuerda say she now dey “back to zero” afta floodwater wash away di food wey she dey sell to live and sweep through her house.

“All my capital don go. I get nothing now,” Cuerda tok, as she wipe away tears outside di concrete house wey she dey share wit her sister. “I no get husband anymore. I no fit rely on my children sake of say dem get dia own families.”

One man, Pedro Parado bin tok for di pharmacy wia e dey work say, e still dey try reason di kain destruction wey di flooding cause.

“We no fit believe say di floods go dey dat great. Everyone dey surprise,” Parado tok.

“Wen di rain bin dey pour, we bin go upstairs. We bin carry all of our tins, including di medicines, so dey no go get wet.”

Fotos from di incident

Gaemi has exacerbated rainy conditions for di Philippines

Getty Images
Gaemi has exacerbated rainy conditions for di Philippines

Predicted path of Typhoon Gaemi

Map wey show how di typhoon go waka

BBC

Source