Rivers State Governorship election result 2023: Siminialayi Fubara win Tonye Cole, Magnus Abe and odas

Di Independent Electoral Commission, Inec don return di Peoples Democratic Party, PDP candidate Siminialayi Fubara as di govnor-elect of Rivers state.

Fubara poll a total of 302,614 votes to beat im closest rival, Tonye Cole of di All Progressives Congress, APC wey poll 95,274 votes.

Millions of Nigerians vote for wetin some sabi pipo say be di most competitive general elections since military rule end.

Nigerians vote to elect govnors and also lawmakers into di state house of assemblies.

18 political parties participate for di polls and unlike di presidential election, na only 28 out of di 36 states of di federation participate.

But asides di govnorship election wey happun for 28 states, elections for members of state assemblies happun for all di 36 states of di kontri.

According to di Independent National Electoral Commission, Inec, 993 State Houses of Assembly seats bin dey up for grabs.

Na 23 local goment areas dey di oil rich Rivers State wey dey Southern Nigeria and Fubara win all of dem.

Move around di map to see di results local goment by local goment

Na here you go see di complete results from di 28 states wen Inec begin declare dem