Why pipo dey slump and die during football match and how you fit watch safely

Pipo wey dey watch football

Getty Images

Di Nigerian Super Eagles team don observe one minute silence to honour pipo wey reportedly die during di semi-final match between dem and Bafana Bafana of South Africa on Wednesday evening.

Di Eagles through dia social media platforms bin post tribute to di victims wey die from across di kontri.

“During di course of our semi-final match, we tragically lost few supporters. For one cruel twist of fate, dia ogbonge passion for di beautiful game den lead dem to dia final moments.

May dia souls find eternal peace, forever remembered for dia love of football and di togetherness wey e bring. Rest in peace.” Di Eagles tok.

During di Nigeria and South Africa game, plenti tension bin dey from both di Super Eagles and di Bafana Bafana especially wen di South African team bin get penalty.

Di game end 1-1 for normal time but Nigeria eventually win 4-2 through penalty.

Na on Thursday morning tori begin come out say some fans die in di cause of di match.

Although BBC Pidgin never independently fit verify dis claims, dis no be di first time we go hear of tori of how pipo dey slump and die during football matches.

Heart risk of watching football

‘Heart for mouth’ moments during one big football match fit put fans’ lives for risk, one research show.

Dis na according to findings of some researchers wey study di effects on German fans wen dem bin dey watch dia home team compete for di 2006 World Cup finals.

Getty Images
You need sabi how to protect your heart against cardiac arrest during football match

Penalty shoot-outs ‘fit trigger heart attacks’

Penalty shoot-outs fit get far more serious consequences dan knockout from football tournament, one study suggest.

Researchers bin find say di number of heart attacks increase by 25% wen England lost to Argentina for one penalty competition for di 1998 World Cup.

Di findings bin provide strong evidence to back up di theory say heart attacks fit dey triggered by emotional wahala.

Also stressful situation fit be anoda problem, sabi pipo tok.

Dem say strong rivalry fit generate stress, wey for some cases, get serious consequence for health.

Researcher Professor Douglas Carroll, of University of Birmingham, bin tell BBC News Online say na two components dey to heart attack.

First, na di long-term build-up of fatty deposits for di blood vessels, and second na di formation of clots, wey block blood supply, and trigger attack.

Im theory na say traumatic, or emotionally disturbing, events like football match fit trigger di second stage of dis process for pipo wey already dey at risk.

Body changes

“Di idea na say traumatic events dey directly affect systems within di bodi, in particular e dey increase blood pressure and di thickness and stickiness of di blood, to create di preconditions clot for people wey dey at risk,” e bin tok.

“You fit get pipo to avoid key football matches, but perhaps dem need take steps to keep calm during dis kind events.

“Maybe pipo suppose watch dis matches wit small, rather dan larger groups so dem fit avoid one kind of excitement.

“Also, maybe e go be good idea to try to moderate consumption of alcohol.”

Professor Carroll suggest say im findings fit make football authorities scrap penalty shoot-out as one way to resolve key matches.

“Di majority of football fans wey I know no like penalty shoot-outs, and say e get provisional health evidence say dey fit no be di greatest tin either, maybe dem go look for alternative solution.” E tok.

How you fit watch football match safely?

Pipo wey dey watch football

Getty Images

Ogbonge sabi pesin Victor Emaye wey dey strongly advocate for beta health and wellness, tok say to watch di Afcon 2023 final fit truly increase chance of shock or heart attacks.

Emaye wey be di co-founder of Chekker add say pipo wey don already get existing heart problems fit dey at high risk and e dey important to take steps to reduce am.

“Before di match, make pipo wey get heart issues go do confam check-up to know say dem dey okay. Dem need to also know di signs wey dey cause heart attack and e include chest pain or feeling out of breath.”

According to Emaye, to dey drink water dey important becos of di kain weather conditions wey we dey currently experience.

“If anyone dey feel say im no dey well during di game, dem fit take a break so dem go fit stay calm even if di match dey very hot and intense.

“Pesin need to also know di nearest hospital and get number of doctor wey go fit attend to emergency.”

Im tok say dis steps fit help fans watch di Afcon wit a safer and enjoyable mind wey no go make dem get health issues.

Source