Aftermath of Afcon 2023 provoke Ghana football fans to protest, demand reforms

Sports journalists and oda football fans for Ghana don dey demonstrate

BBC

Sports journalists and oda football fans for Ghana don dey demonstrate against di poor management of football by di Ghana football association.

Dis protest don dey happun as di kontri journalists tok say dem taya for di way di association dey handle football.

Di Black Stars don crash out of di Afcon for Cote D’ivoire for di group stage for di second consecutive time.

For Cameroon, di Black Stars also exit for di group stage in 2021.

Ghana lose to Morocco, wia dem draw wit Gabon and lose di last group game 2-3 vs Comoros.

Na so di black stars pack dia bags take comot dat tournament.

Fans expect say for dis 2023 tournament, di kontri for fit do better.

But dat be how di Black Stars lose dia first game 1-2 vs Cape Verde, wia dem draw 2-2 wit Egypt.

For di last group game vs Mozambique, Ghana fans don expect say na done deal to progress to di R16.

But di black stars surrender a 2-0 lead for 90 mins wia dem draw 2-2 for dat game afta two defensive errors in four minutes.

Dat be how dem crash out of di tournament without a win.

Dis mean, Ghana neva win di Afcon for forty two years now, di last trophy di black stars win don happun for 1982.

Na so football fans don vex wit di kontri football administrators and di sports ministry.

Dem put pressure wey dem sack di coach Chris Hughton afta ghana exit di Afcon.

But dat neva be di solution to di Ghana football problem, according to di concerned journalists wey dey demonstrate for street.

Di reasons why journalists and fans don dey demonstrate

Di journalists and fans don tok say ‘enough dey enough’ of di mismanagement for football.

Di fans want di Ghana football association (GFA) to answer why football for Ghana don decline.

Dem want make di GFA account for dia stewardship and wetin happun for di Afcon.

Apart from dat, di journalists dey call for “immediate dissolution of di committee wia dem set up to find new coach for Ghana.”

Di group wia one ogbonge journalist, Saddick Adams don dey lead, tok say “e dey premature to find anoda coach, when di GFA neva do assessment of di team im performance for Ivory Coast.”

“I neva support di unsustainable monetization of di black stars. Wetin I support be long-term development of sports ,” Saddick Adams tok.

Di journalists believe say di football association don dey use di black stars as di cash cow wey some players wia get call up to di team neva deserve to go for di tournament.

Tori don dey say di management committee members wey dey carry di team go tournaments dey milk di kontri.

One member of di committee, Alhaji Grunsah don tok recently say, im and im oda committee members receive $100,000 as appearance fee for di 2022 World Cup for Qatar.

More pictures from di protest:

Ghana football protests

BBC
Ghana football protesters

BBC
Ghana football protesters

BBC

Source