Six most popular gifts pipo fit give dia loved ones on Valentines day

Valentine Candy

Getty Images

Valentine don land again!

And all ova di world, na last minute online buying dey happun as pipo dey try get tins to gift dia loved ones.

Valentine Day wey dem dey also call St Valentine Day na day wey pipo dey celebrate love worldwide.

Di day name come from one particular saint but e no really clear who e be and di tori around im life different.

One of di most popular tori be say na priest wey live for di era of Emperor Claudius II wey ban marriages sake of say e dey find men wey go go work.

But Valentine no like di practice so e come dey wed pipo in secret and di ruler no like am so dem put am for prison.

Tori be say na on di 14th of February wen dem bin wan go execute am na wen e send letter to di jailer pikin wey e bin don fall for – e send her love letter wey im sign “from your Valentine”.

Today, pipo around di world dey celebrate love on Frbruary 14 – Valentine’s Day.

Love letter still be o eof di gifts wey pipo dey share but more gifts don join di group, even as practices dey different around di world..

So, wetin be some of di most popular gifts pipo dey give dia loved ones on Valentine’s Day?

Sweets like Chocolates

One survey show say di top gift wey pipo dey collect for America by far na chocolate and oda sweet items.

One tin about chocolate na say e dey seen as aphrodisiac, wey mean say, na sometin wey dey increase di ginger for sex.

In fact studies show say cocoa fit increase blood flow go di lower body parts.

According to one 2021 survey wey one e-commerce platform, Picodi do, 32% of Nigerians dey buy sweet as gifts for dia partners.

Flowers

Pesin wey dey carry flowers

Getty Images

Even though some women go still ask wetin dem wan take flower do, statistics show say na still 20% of women dey get am as gift.

Tori be say di history of giving flowers as gift to celebrate di season bin start for di Victoria era wey fit dey between di 17th and 18th century so di practice don tay small.

Perfumes

Pesin dey spray perfume

Getty Images

Di act of using scent as gifts don even pass romantic love. Dis days, as di celebration of Valentine between friends continue to dey rise, di use of perfumes as gift don dey rise too.

In fact di Picodi survey show say dis na one of di gifts wey both men and women for Nigeria dey collect. As na wetin 40% of women dey get as gift and na wetin 33% of men too dey collect.

Clothes

Clothes na anoda tin wey both men and women dey collect as gift for Valentine Day.

For women, e also include underwear among odas for gifts wey dem dey collect pass.

Experiences

Experiences like going for dates or going outside to chop or watch feem or performances and such don rise in recent years.

E dey even extend to spa dates and even as simple as to comot your house go lodge for one hotel sef.

According to bank card manufacturers, Mastercard, di amount of pipo wey prefer to go out bin rise by ova 300% for di year 2021.

Self-care

Spa Day

Getty Images

One major move for di Valentine gifting environment na say pipo no wan only dey celebrate romantic partners but dem also wan take care of demselves.

All dis tins don turn into wetin pipo dey call self-care buying.

One consumer and retail analyst for Landes Advisors, wey dey stay America tok say many pipo now don dey do wetin she call ‘I deserve am’ buying.

Some organisations now dey organise gift packages now for Valentine wey no be just to gift oda people but for self-care.

E fit include experience gifts like spa dates and tins of dat nature.

Source